How di coronation of Prince Edward Kijanangoma for Tooro Kingdom go hapun today

Prince Edward Kijanangoma
Published
Read am in 4 mins

Tooro Kingdom don dey plan for dia new King, Prince Edward Kijanangoma, wey dem go crown on Tuesday for Uganda.

Dis dey come afta di Ugandan King bin loose dia youngest king eva King Oyo Nyimba Kabamba Iguru wey die of cancer at di age of 34.

Di plan be say later on Tuesday e go dey crowned as king and take up di name King Edward Rukidi Kijanangoma Nyabongo I.

As at Monday dem don do some of di traditional rights wey go put di former TV host for di throne.

Na di Babiito clan, wey be di royal clan of di Tooro Kingdom for western Uganda select Prince Edward Rukidi Kijanangoma on Wednesday, 10 September.

Dis position for new king bin open afta di Uganda President Yoweri Museveni say di King of Tooro, Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV wey die at di age of 34 on Thursday, 27 August die of cancer.

Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV bicom king of Tooro for western Uganda wen e just be three years old for 1995 afta di death of im father.

Although na elected president and parliament dey rule Uganda, di kontri get plenty traditional kingdoms wey get significant cultural influence even though dem no get political power.

Oyo, wey Guinness World Records list as di world youngest reigning monarch, bin rule ova more dan two million pipo.

E be di 13th monarch of di kingdom wey dem establish for di early 19th Century.

Traditional rights to crown new Tooro King and wetin go happun today

Di crowd wey gada di Prince as e bin dey comot one palace go anoda

Some of di rights wey dey hundreds of years old, include to chew coffee beans as part of wetin kingdom put for ground say na di coronation ceremonies.

Dem dey start di coronation from midnight hundreds of pipo follow di Prince waka from di Rwengoma Palace and go through Fort Portal City to di Karuziika Palace wia dem go later crown am.

Many of di pipo wey follow am carry traditional lamps wey dem make from reeds wey dem dry well-well light di road as dem dey waka.

Anoda traditional practice hold wen dem reach di domot of di palace.

Dem fight mock battle between di forces of rival prince wit di forces of di incoming king.

According to di tradition na dis mock battle wia di incoming king go win go give am di transfer of authority as new King.

At dat time, according to wetin di Tooro kingdom Information MInister Charles Mwanguhya tell di BBC Focus on Africa podcast, e go get blessing from members of di royal Babiito clan.

For Tuesday, e go first go church for prayers bifor e go come go back Karuziika Palace to dey crowned as King afta e run oda kain ceremonies wey go stamp im climbing di throne bifor dem carry actual crown give am.

Tooro na one of Uganda traditional kingdoms.

Although, dem say di monarch no get constitutional political power, di kingdom retain considerable cultural and social influence for western Uganda.

Dia monarchs dey recognised as cultural leaders rather dan political rulers.

Who be di new Tooro King

Di 56-year-old Prince Kijanangoma na news anchor and editor for Uganda Broadcasting Corporation (UBC), di kontri state broadcaster.

E be di son of di late Prince Christopher Paul Kijanangoma and grandson of di late Omukama George David Rukidi III.

Prince Kijanangoma also na cousin to di late King Oyo.

Bifor im selection as Omukama, e spend years working as journalist, and na familiar face to television audiences.

E dey present major news bulletins, wey include UBC News Tonight, while covering politics, courts, education plus oda national events.

Prince Kijanangoma generally keep im personal life away from di public spotlight.