South Africa anti-migrant group protest against gender-based violence and illegal migration

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Images)
Hundreds of South Africans enta streets on Wednesday, 30 September to protest against gender-based violence and illegal migration.
Di anti-migrant group March and March bin announce 30 September as deadline for undocumented migrants to comot from di kontri.
For di protest wey happun for Durban, di protesters carry placards wit different messages against illegal migrants and oda tins wey oda kontris dey request from di South African govment.
"March and March until we win, stop GBVF (gender-based violence) no pay 23 billion to foreigners "
"March and March until we win enforce di law secure our borders"
"March and March we stand wit our sisters"
"March and March wat if di killers na illegal migrants"
Dem join di gender based violence sake of di number of women deadibodi wey police don see in di last two months.
Na 12 women deadi bodi na im authorities don find and dem dey chook eye for dis deaths.

Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Images)
For di protest, security pipo hold hands togeda to form barricade in front of di protesters as dem dey waka for road.
No be di first time March and March dey give deadlines for illegal migrants to comot from dia kontri.
Wit di protests for South Africa, foreigners dey continue to run comot from di kontri.
Nigeria recently start new set of evacuation of dia citizens ahead of di deadline wey be Wednesday.
Few days ago, anoda batch of 105 Nigerians arrive Lagos from South Africa.
Dis na as concerns about safety of foreign citizens continue to increase sake of di deadlines wey di anti-migrant groups dey continue to give illegal migrants to comot for di kontri.
Since dis mata start, Nigeria govment and oda Africa kotris neva rest as dem dey work hard to evacuate dia citizens.
Patriotic citizens, organisations and religious groups dey join hands togeda to bring pipo back.
Nigeria Ministry of Foreign Affairs tell di BBC say di govment don facilitate di return of 1,821 Nigerians since June, following wetin dem describe as renewed wave of "Xenophobic and Afrophobic attacks".
Oda Africa kontris don take steps too to make sure dia citizens dey safe.
Ghana govment evacuate di last batch of returnees on 4 September, 2026.
Di Ministry of Foreign Affairs say na nearly 1,900 Ghanaian citizens wey voluntarily register to come back home na im dem evacuate.
Earlier, Ghana Foreign Minister, Samuel Okudzeto Ablakwa, bin accuse di South African govment say dem dey use xenophobia as distraction from di kontri problems.
Di Foreign minister Ablakwa tell di BBC say South Africa no dey do enough to stop attacks on foreigners.
"We don see videos of di South African Police as dem just dey look on, like say dem dey enjoy di scenes as dem dey attack and kill pipo, and properties dey damage," im tok.
Since dis kasala start, Kenya don return about 400 of dia citizens from South Africa.
For July 2026, di South African govment bin reveal say dem don send more dan
53,000 foreign nationals back since di campaign against illegal migrants start.
Most of di deported or repatriated nationals na from Malawi, Zimbabwe, and Mozambique, according to wetin officials tok.
Dem say e possible make di number still rise as more repatriations and deportations go continue.



















