Autopsy report reveal wetin kpai singer Destiny Boy

Wia dis foto come from, Temilola Sobola
Di autopsy result of young Fuji singer, Afeez Adeshina, wey pipo sabi as Destiny Boy, don reveal wetin kpai am two months afta im death.
On January 17, 2026, di young singer bin kpai suddenly at di age of 22.
Im death bin shock many pipo and prompt dem to urge di govment to do autopsy to establish di cause of im death.
Videos wey show im body as dem dey transport am to mortuary circulate on social media cause speculation and conspiracy theories about wetin fit don kpai am.
Some social media users bin question di handling of di case, while odas dey demand transparency.
Oda social media users express concern ova di lack of post-mortem examination bifor dem bury di singer.
As di rumours of wetin kill am bin dey circulate online, Destiny Boy mama, Saida, release one video on Monday 19 January wia she address di cause of her son death.
She say di singer bin don dey battle long-term illness wey dey always cause seizures.
According to her, di illness, locally referred to as "Ogu oru", bin don persist for years and require both medical and traditional treatment. She explain say di family bin take Destiny Boy to several hospitals and also seek traditional remedies so dem go fit stabilise im condition.
"We bin no let di public know about dis becos na superstar. We take am to churches, herbalists, etc for am to get a cure but no level," she tok.
However, di Ogun State Police Command tok-tok pesin, DSP Oluseyi Babaseyi, tell BBC News Pidgin on Saturday 4 April say di autopsy result of Destiny Boy confam say di young singer bin overdose on tramadol and methamphetamine.
For one text message to BBC News Pidgin enquiry, Babaseyi say di report reveal harmful levels of tramadol and im metabolites, as well as methamphetamine, for di body of di deceased.
"Di Consultant Anatomic Pathologist report say toxicology results bin reveal harmful levels of tramadol and im metabolites, as well as methamphetamine, and opine say di cause of death na aspiration pneumonitis wey result from di ingestion of dis toxic substances, wit di date of death being 17/01/2026," Babaseyi tok.
Who be Destiny Boy
Afeez Adesina aka Destiny na fast rising Nigerian Afrofuji singer wey dem born on June 24, 2004.
Bifor im death on Saturday 17 January, im be one of di most promising young talents for Nigeria music scene. E dey fuse Fuji music wit contemporary Afrobeats.
E break into di spotlight for 2019 wen im Fuji-inspired cover of Davido hit song If bin go viral on social media, and make am popular at di age of 15 years old. Di success bin mark di start of im music career as e release original songs, reinterpret popular hits and perform for audiences across Nigeria and beyond.
Destiny Boy die for Ijebu-Ode, Ogun State, southwest Nigeria. E leave behind a partner and dia pikin wey dem born for November 2024.










