Mama of three children wey car accident kpai di same day for Port Harcourt tok how e happun as she cry for justice

Wia dis foto come from, Amarachi Promise Morris Amadi
- Author, Karina Igonikon
- Role, Reporter
- Reporting from, Port Harcourt
- Published
- Read am in 6 mins
Amarachi Promise-Amadi dey cry for justice for di deaths of her three children wey one car learner allegedly kpai.
She give di children names as 10-year-old Peculiar, four-year-old Chidubem and three year old Chikaima.
She tell BBC News Pidgin say di incident happun for di evening of Friday 15 May, 2026 around 8:45pm wen one young woman wey dey learn how to drive motor wit her boyfriend allegedly crash into di three children wey bin dey in front of dia house for Yam zone area of Ogbumnabali area of Port Harcourt, di Rivers State capital.
"Dat evening, we just dey outside our compound wit oda neighbours dey relax. Me, my first daughter, my only son and my second daughter wit my girl and oda neighbours. One of dem, one Hausa man na im carry my second daughter sidon outside.
"I just step aside to answer call inside our compound, di next tin I hear na gboaaa! Aunty! Naso I rush out - wetin I see I no fit believe am.
"From di passenger side, a young man na im come out. One young lady dey di driver side. I ask am, "wetin I do you wey make you kill my children?" she tok.

Amarachi say di impact of di car crash into di place wia her children and neighbours bin sidon, destroy di building wey make di building blocks fall on top dem.
She say na one neighbour wey hear how di accident happun na im see her house help and rush her go a nearby hospital wit some serious injuries.
Anoda neighbour see her first daughter, rush her go anoda hospital wey dey opposite dem and some pipo help to bring out di Hausa man wey bin carry her daughter.
"I say my two children still dey dia. Di lady wey dey drive di motor come down dey look for her wig, na im I hold her, hold di man wey dey wit dem say dem no go go anywia, wetin I do una wey make una take my children?"
Amarachi add: "Wen dem lift di stone wey bin dey on top my son, my son don divide into two. I say my second daughter still dey dia, wen dem bring her out, she dey lifeless."
She say di small hope she bin get say her first daughter wey dem rush go hospital fit survive and wen she reach di hospital, di hospital staff ask her to pay deposit say dem don rush her into di theatre. But na one neighbour na im tell her say dem keep her daughter for bench outside.
"Wen I go out go meet her, foam dey her mouth. My daughter don die. Chai, I lose my three children one day!"
Amarachi say since e happun she neva fit sleep as she neva fit accept say her three children just die same time, same day.
"Evri day I wake up in di morning and remember dem. Evri day my alarm go ring 5am but no children for me to dress up for school."
'I leave my four children travel, come back to only one wey remain' - Papa

Wia dis foto come from, Amarachi Promise Amadi
"I leave my four children travel, come back to only one wey remain,” na so Morris Amadi wey be di papa of di children lament as e tink of di incident. E say na wia e travel to Akwa Ibom for one burial im get call say im children don die.
"Na di pipo around hold me down as I shock wen I hear di news.
Di next Saturday, I rush come back and see say true true my three children don die."
Amarachi and Morris Amadi say dem no like di way di Police wey dey handle di mata dey do.
Di mama of di children say she no know who call di police but na wen dem dey di hospital wia her girl dey receive treatment dem see two policemen.
Dem follow dem go Old GRA Police Station and dem carry di two pipo wey allegedly cause di accident and take dia statements.
Amadi say wen e kon go di Old GRA Police station, dem say dem don refer di mata to Mile One Police station, only for dem to turn am back to Old GRA Police Station.
"Now dem tell us say di two pipo dey custody for Mile 1 Police Station and dem dey wait for di report of di Traffic Unit and VIO, but dem no let me see di pipo wey cause di accident."
Amarachi also tok about di attitude of di health personnel as she say afta dem rush her girl from di private hospital to di state-owned teaching hospital, dem first demand for payment and despite making payment, dem no attend to her till dem get to take her from dia to anoda private hospital wey quickly attend to her and na dia she still dey receive treatment.

Wia dis foto come from, Amarachi Promise Amadi
Rivers State Police Command say dem don begin investigate di incident.
Police tok-tok pesin ASP Blessing Agabe Kaborlo for statement confam di incident say di command dey committed to uncover di circumstances wey surround di incident to ensure say any pesin wey dey culpable go face justice and dem call for calm.
Meanwhile, di deadibodi of di three children dey deposited for di Military Hospital mortuary for Port Harcourt.
For Amarachi, na four losses as she say she dey prepare for di burial of her mama wey dey expected to hold next month wen bifor di tragedy of losing di children at once happun.
"My last pikin, my two year old daughter wey remain dey ask for her brother and sisters and we no know wetin to tell her.
"We get to remove dia fotos, and anytin wey belong to dem for di house as she dey cry and call dia names. Now she dey my sister house.
"My heart dey heavy, I no get strength again. I want justice for my children. My children no go just die like dat," Amarachi tok.
She add say apart from her three children wey don die from di accident, three oda pipo don also die from dis incident and one pesin dey receive treatment while two odas dey inside coma.










