'Na democracy we dey, no be military regime' - Desmond Elliot tok ahead of APC house of assembly primaries

Nigerian actor-turned politician Desmond Elliot don carry mata enta anoda level ontop di political drag-drag wey dey go on between am and im godfther, Femi Gbajabiamila, for Surulere constituency.
Desmond wey dey seek re-election back into di Lagos State House of Assembly as member wey go represent Surulere Constituency 1, say im dey sorry for anytin wey fit dey vex Gbajabiamila.
For im exclusive interview wit di BBC News Pidgin, Desmond tok wetin fit be di next tin for am in case tins no go well wit di primaries wey e dey contest for.
Desmond go face anoda aspirant for di primary election, and indication dey show say di fight between am and Gbajabiamila fit make di outcome no favour am, afta im campaign director join alliance wit di opponent.
All dis gbege begin sup wen Gbajabiamila wey be Chief of Staff to President Bola Tinubu, say e hear say Desmond Elliot get hand for di speaker crisis wey rock di Lagos House of Assembly earlier dis year.
Desmond, wey dey try get di ticket of di APC to return to di Lagos State House of Assembly go know im fate today as di party hold dia primaries.
During dat time, members of di Lagos State House of Assembly impeach dia speaker, Mudashiru Obasa, wey dey serve im third term as speaker.
Dem accuse am of gross misconduct and abuse of office and di lawmakers elect di deputy speaker Madam Mojisola Meranda as di new speaker.
E no tey wen di mata die down as dem return Obasa as speaker.
Wen BBC News Pidgin ask Desmond Elliot wetin be im role for di Lagos State House of Assembly saga, e say, im no wan tok about am.
'Pikin don say sorry to papa, papa go cool down wen papa ready'
During di interview, Desmond say im don tell Gbajabiamila sorry ontop di mata. E add say e no fit decide wen Gbajabiamila go calm down.
"Pikin don tell papa sorry, papa go cool down wen papa ready, but no be me go tell papa wen papa go cool down," Desmond tok.
"I go still dey pray to God make e no make papa vex."
Several supporters dey look say di gbege between Desmond and Gbajabiamila fit cost am di Lagos State House of Assembly ticket.
Wen we ask Desmond wetin e go do if di outcome of di primaries no favour am, e no too tok much but agree say im go still dey di party.
E say im still be party member and e go still follow di party.
"I still be party member, I go follow my party."
'Oga na Oga' - Desmond Ellliot
On di oda hand, Elliot say na democracy Nigeria dey practice and no be military regime, so evritin wey dey happun go happun.
E say di relationship between am and Gbajabiamila na like papa and pikin and wen issues happun, dem go later settle am.
"Na democracy we dey no be military regime. Oga na oga, relationship na wen pesin na your padi, im no be my padi, na my oga."
Desmond say im dey loyal to Gbajabiamila and di former House of Reps Speaker love am as 'im boy'.
"No how for dis life wey papa and pikin no go get small issues, dem go settle am, so no be problem. Make we no blow di tin pass wetin e suppose be."









