'Each Witness gatz decide' - Jehovah's Witness announce new change on blood transfusion and donation

Blood bag afta dem don seperate blood patelets

Wia dis foto come from, DESIREE MARTIN/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Blood bag afta dem don seperate blood patelets wey dey allowed under Jehovah's Witness new adjustment
Published
Read am in 5 mins

Jehovah's Witness say dem don review dia position on di blood transfusion wey concern dia members.

Whole blood transfusion no dey allowed for Jehovah's witness but now e dey allowed to donate or collect parts of di blood from anoda pesin, depending on wetin di pesin conscience fit accept.

Dis dey come from di international tok-tok pesin of di Jehovah's Witnesses, Paul Gillies wey announce am on Friday.

Di governing bodi decision to let dia pipo to accept parts of wetin make di blood wey include red cells, white cells, plasma or platelets.

Dem also address di mata of donating blood say na di 'Witness decision if dem wan donate for di clear purpose of extracting parts of di blood so anoda pesin go fit use am.'

"Each Witness gatz decide weda or not to donate blood for di clearly expressed purpose of providing components or fractions for use by anoda pesin," Jehovah's Witness tok for dia statement.

According to dia statement, dia long standing decision to reject whole blood transfusion neva change bicos e dey inside Bible as dem quote Acts 15: 20 wey in whole tok say, "But we dey write to dem, make dem abstain from pollutions of idols and from fornication, and from tins wey dem strangle and from blood".

Paul Gillies bin comment on di mata, say, "Blood still be sacred tin to Jehovah's Witnesses wey dey continue see life and blood as special gifts from God. We recognize say medical decisions wey need blood parts na mata of conscience between di pesin and God".

Jehovah Witnesses na one of di Christian-based religious movement wey dey known for dia door-to-door evangelism.

Why Jehovah's Witness take new decision on blood donation

According to dia statement, dis one dey come bicos di Bible no tok about di mata of di parts of di blood but just di whole blood.

Di statement add say Jehovah's Witnesses like life and wan dey use di best medical care as dem no believe in faith healing.

Di tin be say, di Bible no tok about di mata, na why earlier dis year, di JW bin make decision to allow pipo to use dia own blood for medical procedure.

Dem say dat one too na down to personal conscience.

Oga Gillieies tok say, "congregations no dey chook dia mouth for personal decisions for wetin dey rest for individual conscience."

E add say, "we dey grateful too for di many skilled and compassionate physicians wey dey give beta medical care wey respect our personal wishes as e gatz to do wit blood."

Blood bag wit paper on am and stethoscope beside am

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin to know about Jehovah's Witness blood transfusion policy

For March 2026, di govning body of Jehovah Witnesses clarify dia position on di use of patient own blood for medical and surgical care situation.

Wit dis new change, Jehovah Witnesses now allow dia members to do transfusions using dia own blood for situation of surgeries and oda medical conditions.

Meanwhile, dem still no dey allow dia members to receive blood from odas.

Leadership of di Jehovah Witness say dia decision to change dia blood transfusion policy na to allow dia Christian members choose for diasef how dem want make dia blood dey used.

According to one representative wey speak for di video wey dem make availbale for dia website, Jehovah Witness say di Bible dey silent on issues wey concern how dem go use a pesin own blood.

"Afta plenti prayers and consideration of di scriptures, di govning body don decide to clarify on position on di use of a patient own blood for medical and surgical care," representative of di Jehovah Witnesses govning body tok.

"Our clarification be dis, each Christian gatz decide for demsef how dem go use dia own blood for all medical and surgical care. Dis include weda to allow dia own blood to be removed, stored, and giving back to di owner."

Wetin dis one mean? Jehovah Witness explain further say dia members fit allow make dem collect, store and reuse dia own blood for dem wen dem need am for medical issues.

"Some Christians fit decide make dem store dia blood and give back to dem, odas fit reject am. All Christians gatz decide how dia own blood go dey used in situation of medical and surgical care."

For dia explanation as to why Jehovah Witness dey amend dia policy, dem say Christians no dey under di Mosaic law, but na di Apostolic law dem dey obey wey 'say make we stay away from blood.'

"Di Bible no comment on di use of a pesin own blood for medical and surgical care situation."