Wetin be Niger money policy wey dem set to fight terrorism and money laundering

Wia dis foto come from, ORTN - Télé Sahel/AFP via Getty Images
Niger junta-led govment don bring in new rules wey go control how pipo dey move large amounts of cash for di kontri.
Dem say dis na part of efforts to fight money laundering and di "financing of terrorism".
Di govment say security forces dey regularly check large cash movements, but di new measures go help dem identify suspicious transactions while e go allow legitimate money to move freely.
Niger dey rank 120th out of 145 kontris wit di strongest military for di world, as di Global Firepower Center tok, one research center for global military power, tok for 2026.
Di kontri dey face serious terrorists activities and in recent times, dem don witness attacks wey lead to death of several pipo.
For September 2026, Niger army say dem find large amount of weapons and military equipment for Base 101 for Niamey afta di failed mutiny wey happun for different parts of di kontri.
Dem say di weapons wey dem uncova include heavy weapons, rockets, explosives and large quantities of ammunition.
Since dat time, Niger don dey put measures in place to check di activities of terrorists and oda jaguda pipo wey dey cause kasala for di knotri.
Wetin be di new policy on movement of money for Niger
General Abdourahamane Tiani govment of Niger don declare say make nobodi carry big amount of money wey pass di amount wey dey bank regulations.
Di govment say anybodi wey carry cash wey pass di limits wey banking regulations set gatz declare am to di relevant authorities in advance.
Di Niger state news agency report di announcement on Tuesday but e no provide details of di cash limits.
Dem say pipo wey dia documents match di amount of money wey dem dey carry go fit kontinu dia journey witout delay.
But authorities fit investigate if money no dey declared, if documents no match, or if dia be serious suspicions of wrongdoing.
"Howeva, in di event of failure to declare, document inconsistencies, or serious indications of offense, di inspections and procedures wey alreadi dey for di current legislation go dey enforced," Niger govment say.
Di govment say money wey dem seize or hold bifor go return to di rightful owners once dem provide proof of im origin, ownership and intended destination, provided say no legal obstacles dey.
"Acting on di instructions of General Abdourahamane Tiani, funds wey dey previously seized or withheld go dey returned to dia rightful owners once dia origin, ownership, and intended use don dey duly determined and provided say no legal wahala dey," di statement tok.
Niger na one of several kontris for di Sahel wey dey battle jihadist insurgencies.
Di govment say di new measures na to make am harder for criminal and militant groups to move money through illegal financial networks.
"Through dis measures, di govment aim to strengthen di fight against terrorist financing and illicit financial channels."
Niger military junta take power for one coup for 2023, promising to restore security and tackle di jihadist insurgency.
However, attacks by armed groups don kontinu, and violence don increase for some parts of di Sahel in recent months.
For 11 September, Niger military rulers replace di head of di armed forces, less dan two weeks afta one deadly mutiny wey bin challenge dia authority.
Di decree wey dem read on state television late on Friday, 11 September, 2026, bin announce say Brigadier General Mamane Sani Kiaou na di new chief of staff.
Im succeed Major General Moussa Salaou Barmou, wey be senior junta figure since di July 2023 coup wey bin remove President Mohamed Bazoum.
















