Nigeria First Lady Remi Tinubu respond to 'Akara' social media trend

First Lady Remi Tinubu

Wia dis foto come from, Remi Tinubu/Facebook

Published
Read am in 3 mins

Senator Oluremi Tinubu, wife of Nigeria President Bola Tinubu say no amount of criticism or misinformation go stop her pledge to support women wey dey do small-scale business for di kontri.

The First Lady tok dis one for Hadejia, Jigawa State Northwest Nigeria wen she go inaugurate one of di Abubakar Maje Haruna Hall for di Emir of Hadejia Palace wey dem just build.

Dis na di first time she dey tok afta her comment about 'akara', 'kuli-kuli' and 'corn' begin trend.

Madam Tinubu tok am wen she dey address tori pipo afta di second-quarter meeting of di Renewed Hope Initiative wit wives of state govnors for di State House for Abuja on Wednesday, 24 June.

Presido wife say "We dey try to give hope, and to start akara business no cost plenty money. To start roasting corn, or pesin even say kuli kuli no dey take much. We bin no give dem loan; we bin give dem as grant.

"So we don encourage Nigerians di best wey we fit do. Wetin dey within our hands, I don give, and I dey continue to give," she tok.

Video of di First Lady wia she make di comments quickly go viral on social media on Friday and Nigerians dey divided on dia opinions. Some also use am as trend for social media

Di Nigeria First Lady dismiss tori say wey dey spread for social media sake of her economic empowerment programme.

Madam Remi Tinubu match leg for ground say di aim of di initiative na to improve di livelihoods of grassroots women and to also strengthen small businesses.

As part of di programme, di former senator announce 200 million naira ($144,690) support package for 2,000 women wey be petty traders for Jigawa State.

She use di opportunity tell pipo wey dey criticise her say di programme no be only for akara sellers, she add say e cover plenti small-scale traders.

"I dey hear pipo dey tok about akara sellers. No be only akara sellers. We dey support tomato sellers, maize sellers, vegetable sellers and many oda petty traders. Our goal na to help women grow dia businesses and become financially independent," she tok.

Di wife of di Nigerian president say to empower women still be di key strategy to reduce poverty, wey go boost household income and promoting economic growth for di grassroots.

Madam Tinubu say Nigeria get plenti human and natural resources wey be blessing as she assure pipo say di Tinubu lead administration go continue to implement programmes wey go improve di welfare of citizens, especially women and vulnerable groups.

She also tok say Nigeria belongs to all di citizens and make evribody joinbody towards national development and prosperity.