You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Which options ADC get?
Nigeria join-bodi opposition party, di African Democratic Congress (ADC) don dey consider di options wey dem get as dia issue wit di Independent National Electoral Commission (Inec) kontinu to dey linger.
Dis dey come afta Inec tok say dem no longer go recognise former Senate President David Mark and former Osun State govnor Rauf Aregbesola as di chairman and secretary of di ADC.
Inec say dia decision na sake of one order from di court of appeal afta one former deputy national chairman of ADC, Nafiu Bala Gombe, bin go court to challenge di David Mark and Aregbesola leadership.
For dia statement, Inec say deM go stop to dey deal wit Mark and Aregbesola as leaders of ADC, but dem still no go recognise Nafiu Bala Gombe as chairman of di ADC until di mata for court don settle.
Di situation don put di party for limbo, as political sabi pipo tok say e don leave di ADC witout any valid leadership, ahead of dia national convention wey dem bin don plan to hold on 14 April, 2026.
So which option dey bifor di opposition party now?
Return to court
According to di court of appeal order wey Inec use withdraw di recognition of di ADC leadership, di mata of who be di ADC authentic chairman don already dey bifor di federal high court for Abuja, and di appeal court give order make dem decide di case fast fast.
Former Vice President Atiku Abubakar, wey be one of di oga dem for di ADC, tell di BBC for interview say dia lawyers don go back to court and e believe say dem go win for di mata.
Rememba say Inec don already release timetable for di 2027 general elections and deadlines dey wey parties suppose present dia candidates, wey be say if dem fail to meet di deadline, dem don dey disqualified for di election.
"We no dey disturbed by di judgement, we don already go bak to di trial court, and we believe say di trial court go decide di case as soon as possible, maybe bifor even we start our congresses," Atiku tok.
Leave di ADC, join anoda party
Some pipo don suggest say make all di big political oga dem for di APC just leave di party at once and join anoda party, as e be like say Inec dey try to frustrate dem.
But wen di BBC ask former Vice Presiden Atiku Abubakar about dis option, e tok say di idea no be good one.
"Some of dis parties no get di structures," Atiku tok. "Di ADC na join-bodi movement wey we start about one and half years ago, so plenty preparations don go into am. So we wan just make sure say all di judicial process dey concluded as soon as possible so we go. continue wit our political activities."
Mount public pressure on Inec
Already, di ADC don start wetin look like ogbonge media campaign for both di traditional media and social media spaces, to try to win public opinion for dia side as dia wahala wit Inec continue.
On Monday, di tok-tok pesin for di ADC, Bolaji Abdullahi, issue statement wia e allege say Inec dey deliberately put "land mines" for di ADC to make sure say dem no bring out candidates for di 2027 general elections.
For dat statemet, oga Abdullahi, who be former Minister of youth and sports devleopment for Nigeria, publish plenty documents, wey e tok say na di process wey dem follow during di time wey dem wan form di ADC join-bodi movement, and say Inec dey aware and bin approve of evritin dat time.
"Despite dis clear documentary trail, INEC don now tak di position say dem no go receive any correspondence from di ADC again pending di determination of a matter bifor di Federal High Court. Dis na wia di contradiction don bicom dangerous," Abdullahi tok.
Di ADC tok-tok pesin also publish documents wey show say Nafiu Bala Gombe, di former ADCdeputy national bin attend all di meetings durin di process of forming di join-bodi movement, and e bin voluntarily resign im from im position to create chance make di join-bodi waka work.
"We dey also call on Nigerians to dey careful and remain vigilant about dis dangerous machinations (by Inec) to scatter Nigeria democracy and impose civilian dictatorship for di kontri."
Similarly, di youth wing of di ADC say dem don give Inec three days to recognise David Mark as di authentic leader of di party, restore im name for dia portal, and start to dey relate wit dem again.
Dem also demand make Inec apologise for wetin dem do and for di Inec chairman Joash Amupitan to resign bicos, according to dem, e dey partisan.
"If Inec fails to comply witin 74 hours, we go initial lawful civic action across all di 36 states of di federation and di FCT," di ADC youth leader, Balarabe Rufai tok for one press conference on Monday.
Go ahead wit activities
Anoda option na make di ADC no just mind Inec and just go ahead wit dia activities.
Dis na according to Ralph Nwosu, di former national chairman of di ADC who also resign togeda wit all im exco to make way for di join-bodi movement and for David Mark to bicom chairman.
Nwosu tell tori pipo say govment institutions belong to di pipo, and if Inec no wan do dia job witout bias, den ADC suppose go ahead wit dia activities so long as dem carry di pipo along.
"If true-true na di Nigeria pipo get am (Inec), any presentations we dey make, if INEC refuse to receive am, we go advertise dem for all Nigerian newspapers and put dem for all di radio stations so dat di Nigeria pipo go see say we dey follow transparent process. Di institutions na di Nigeria pipo get am. So, dat na wetin we go do bicos wetin Inec dey do dey wrong," Nwosu tok for interview wit local newspaper Daily Trust.
Already, as Inec don release di election timetable, sabi pipo say time dey run against di ADC and dem gatz do fast wit anytin wey dem wan do.
For instance, di period for parties to hold dia primary elections and forward di names of dia candidates to Inec na betwin 23 April to 30 May, 2026.
Na di names wey reach Inec bifor di dates go be di pipo wey go folo contest di election, and if by dis dat di wahala betwin Inec and di ADC neva settle, e don be for di opposition join-bodi party, political analyst Lekan Ige tell BBC News Pidgin.