Champions League quarterfinal: Real Madrid, Bayern, Arsenal, Sporting CP play for UCL

Read am in 6 mins

Di quarterfinal stage of di Uefa Champions league go start on Tuesday wit first leg of crucial games.

Bayern Munich wey many sabi as di best team for Europe dey face di record holders Real Madrid for di Santiago Bernabeu.

Di two teams don jam each oda many times for di competition recently wey Real Madrid get good results against di German team.

At di same time, premier league leaders Arsenal dey travel to Portugal to face Sporting CP.

Di gunners recently dey under pressure afta dem lose two games against Manchester City (Carabao cup final) and Southampton (FA Cup quarterfinal) - meaning say dem now gat chance for only two titles now.

On Wednesday Barcelona go host Atletico Madrid for di Camp Nou wey Liverpool (also dey under pressure), go travel to France to face Paris Saint Germain.

All four quarterfinal games go happun at 7 PM GMT (8 PM WAT) on Tuesday and Wednesday.

Real Madrid v Bayern Munich

Dis go be di 29th time Real and Bayer bin dey face each oda for di competition, but Real Madrid don comot di Germans for di last four two-leg games, wey dem also dey unbeaten for dia last nine games against Bayern (W7 D2).

Alvaro Arbeloa im team gat di home advantage as dem plan to close di roof for di Bernabeu to put pressure of di opponents and increase di noise for di stadium.

Bayern Munich bin dey lead di Bundesliga – dem also finish second for di league phase of di UCL wit nine wins from 10 games.

Vincent Kompany go dey happy say im star striker Hary Kane don travel wit di team to Spain afta im recover from injury.

Dem also stage comeback from 2-0 to win 2-3 away against Freiburg ova di weekend.

Bayern don feature for di UCL every season since 2008/2009 wey dem reach di knockout stage every time.

Sporting CP v Arsenal

Arsenal striker Viktor Gyokeres bin dey return to face im former club wia im score more than 90 goals in two seasons.

Di English team bin dey face backlash afta dem comot for two competitions – di Carabao cup and di FA Cup.

Di gunners dey unbeaten for European competition against Sporting (W2 D3) – for di 2024 season dem sama Sporting 5-1 for Lisbon.

But di only time dem play two-legs, Sporting bin win for penalties to comot Arsenal for di 2022/23 Europa league R16.

Sporting don win nine out of dia 10 Uefa competition wey be two-legs against English opponent.

Dem dey hope to be di first Portuguese team wey go win quarterfinal game since Porto do am for 2003/04 wey dem eventually win di trophy.

Arsenal bin reach di semifinal last season afta dem beat Real Madrid but dem lose to PSG wey bin win di title.

For dis game dem get some injury to key players like Saka and Timber; odas like Rice, Gabriel and Trossard dey fit afta dem recover from injury.

Later for Wednesday, Atletico go jam wit Barcelona wey Liverpool go meet PSG for Paris.

Barcelona v Atletico Madrid

Dis two teams don already face each oda four times dis season - two times for di Spanish league and two times for di Copa Del Rey.

Atletico bin comot Barcelona to reach di Copa Del Dey final wit Real Sociedad wey Barcelona beat dem two times for di league – one of dem happun ova di weekend.

But Diego Simeone gatz eyes for di UCL na so im rest some of im players (Lookman and Alvarez) ahead dia midweek clash wit Barca.

Atletico gatz di edge for head-to-head – dem bin win di two quarterfinals for 2013/14 and 2015/16.

Barcelona go hope dia home ground wia dem bin win all dia games dis season go help dem; especially as dem already sama Atico 3-0 for di second leg of di Copa Del Rey, even though dem no fit complete di remontada.

Diego Simeone go plan to contain Barcelona and limit dia chances and hope say dem fit create chance to hurt di Barcelona highline and carry advantage to di Metropolitano for di second leg.

Hansi Flick go also expect im team to take dia chances especially as Raphinha, De Jong and Marc Bernal no dey available.

PSG v Liverpool

Anoda coach wey bin dey under pressure na Arne Slot. Di Liverpool manager dey on di verge of trophyless season just one year afta dem win di premier league.

Dem dey fifth for di league table wey dem comot all di domestic cup competition.

Dia only hope for trophy na di UCL.

But dem first gatz to face PSG – di defending champions.

Di two teams already bin meet each oda for di R16 last season when PSG win for penalties on dia way to win di trophy.

Liverpool bin win seven of dia last 11 European matches against French teams go hope to get good result for Paris bifor dem return to Anfield.

Liverpool don win six of dia last eight UCL quarterfinal games.

PSG don win dia last four two-leg games against English clubs; dem sama Chelsea dis season, sama Liverpool last season for R16 wey dem also comot Aston Villa for di quarterfinals and Arsenal for di semifinals.

Tuesday fixtures

  • Real Madrid v Bayern Munich – 7 PM GMT (8 PM WAT)
  • Sporting CP v Arsenal - 7 PM GMT (8 PM WAT)

Wednesday fixtures

  • PSG v Liverpool - 7 PM GMT (8 PM WAT)
  • Barcelona v Atletico Madrid - 7 PM GMT (8 PM WAT)