Head of Iranian Revolutionary Guards Intelligence Organisation Majid Khademi don die for US-Israeli strikes

Read am in 5 mins

Dem don kill Majid Khademi, wey be di head of di Iranian Revolutionary Guards' Intelligence Organisation, according to informate from di state media.

Dis dey come few days afta di Revolutionary Guards confam di death of of dia commander, Alireza Tangsiri "sake of severe injuries."

According to Iranian media, di commander of di IRGC navy die for one Israeli attack on one building for Bandar Abbas.

Meanwhile, di announcement of di death of di IRGC Intelligence Organisation come on Monday, as di US-Israel war still dey go on.

IRGC issue statement, according to state media wia dem announce di killing of dia martyrdom Brigadier General Seyyed Majid Khademi, head of the IRGC Intelligence Organization.

Di military body no provide any further details about di location of wia Khademi bin die.

Dis death na di latest of di top Iranian security pesin wey don kpai for di Israel-US airstrikes.

Na inside same war Israel to say dem don kill Iran top security official, Ali Larijani, plus di head of di paramilitary Basij force, Gholamreza Soleimani. Dat one happun for March 2026.

More informate wey come on di death of Iran intelligence chief, Israel Defence Minister Israel Katz and di Israel Defense Forces (IDF) claim responsibility for di killing of Majid Khademi.

Di IDF write for Telegram dat di killing na "anoda severe blow" to si Iranian Revolutionary Guard Corps (IRGC).

Who be Majid Khademi

Khademi bin replace Mohammad Kazemi, wey dem also kill for anoda Israeli attack for 15 June 2025 during di 12-day Iran-Israel war.

Meanwhile, Majid Khademi appear for media under two names- sometimes e dey introduced as Majid Khademi and sometimes as Majid Hosseini.

E previously head of di Intelligence Protection Organization of di Ministry of Defense and di head of di Intelligence Protection of di IRGC.

Wen Brigadier General Mohammad Kazemi, di former head of di IRGC intelligence protection, dey appointed as di successor to Hossein Taeb, di head of di IRGC intelligence organization, Khademi take im place for di intelligence protection.

Khademi na well known military figure sake of di different security positions wey e don hold for Iran.

Although dem transfer Majid Khademi di Iran Ministry of Defense intelligence protection to di IRGC intelligence protection, e get long history of serving for di IRGC.

E serve as deputy director of di IRGC Intelligence Protection Organization for sometime bifor e later become director.

Dem appoint Majid Khademi as head of intelligence protection for di Ministry of Defense for May 2018.

Bifor im death, Majid Khademi serve as head of Iranian Revolutionary Guards Intelligence Organisation.

How strong di IRGC be for Iran

Di IRGC na Iran main organisation for maintaining internal security, and now na major military, political and economic force for di kontri, wit more dan 150,000 personnel.

Wit dia own ground forces, navy and air force, na dem dey oversee Iran strategic weapons.

Dem get overseas arm wey dem dey call di Quds Force wey secretly dey provide money, weapons, technology and training to allies throughout di Middle East.

Na dem dey also control di Basij Resistance Force.

Trump threaten 'hell' if dem no make deal but Iran issue retaliation warning

US President Donald Trump don publish one expletive-laden post for social media wia e threaten to destroy Iran power plants and bridges if dem fail to meet im new Tuesday deadline to reopen di Strait of Hormuz.

"Tuesday go be Power Plant Day, and Bridge Day, all wrapped up in one, for Iran," e write. "Dia will be nothing like am!!!"

Initially, im deadline na Monday 6 April, afta e post am on Saturday 4 April say Iran get "48 hours" to make di deal.

But hours afta e post im latest threat to Iran on Truth Social wey reference "Tuesday", Trump follow up wit "Tuesday, 8:00 P.M. Eastern Time!" (01:00 BST on 8 April) - wey signify extension of di deadline.

Di US president don postpone deadlines for di reopening of di Strait of Hormuz several times.

Later on Monday evening, Trump also tell di Fox News say "good chance" dey to reach a deal on Monday, but e dey consida to "blow evritin up and taking ova di oil" if dem no make one deal quickly.

Di president latest remarks come as e announce say di second crew member of US fighter jet downed ova Iran don dey successfully rescued for operation deep inside hostile territory.

Meanwhile, Iran don warn of "much more devastating" retaliation if di US and Israel strike civilian targets, state media report

"If attacks on civilian targets dey repeated, di next stages of our offensive and retaliatory operations go dey much more devastating and widespread," according to statement from tok tok pesin for di Khatam al-Anbiya Central Headquarters - Iran highest operational military command unit.

Islamic Republic of Iran Broadcasting (IRIB) bun publish di statement.

Dat Iran warning threat na sake of US president threat to attack Iranian power plants and bridges if Iran fail to meet di Tuesday deadline to reopen di Strait of Hormuz.