Hurricane Ida: Pictures show how di storm battle US Gulf Coast

Waves ontop Lake Pontchartrain, Louisiana (29 August)
Wetin we call dis foto, Di storm carry water from Lake Pontchartrain, for south-eastern Louisiana enta di ciity of New Orleans
Published

Di US city of New Orleans no get light and na only generators dey work as Hurricane Ida dey hammer Louisiana.

Hurricane Ida land for di US state of Louisiana, on di 16th anniversary of Hurricane Katrina.

Di storm bring like 150mph (240km/h) winds with am wen e make landfall and pipo wey no run don get advise from authorities to take cover.

US President Joe Biden don say e fit take weeks for di electricity to come back and say Ida fit dey "life threatening" and fit cause ogbonge palava beyond di coasts.

See some ogbonge fotos wey shows as di Hurricane land

Men dey run inside hurricane
Wetin we call dis foto, Ida carri heavy winds enta New Orleans
Mama dey comfort her grandpikin as di storm bin dey near New Orleans
Wetin we call dis foto, Mama dey comfort her grandpikin as di storm bin dey near New Orleans
Pipo dey waka for di French Quarter on Sunday for New Orleans
Wetin we call dis foto, Pipo dey waka for di French Quarter on Sunday for New Orleans
A man pushes a shopping trolley through the wind and rain in New Orleans
Wetin we call dis foto, Pipo still dey waka up and down even though authories don ask pipo make dem find shelter
Residents dey make preparation for di storm.
Wetin we call dis foto, On Saturday, pipo bin don already start to make plans in preparation for di storm
Hurricane Ida as dem see am for dis fot dem take for di International Space Station
Wetin we call dis foto, European Space Agency astronaut Thomas Pesquet bin take dis picture of Hurricane Ida on Sunday from di International Space Station