US plan to dey register young men automatically for military draft eligibility

    • Author, Bernd Debusmann Jr
    • Role, White House reporter
  • Read am in 4 mins

Young American men fit automatically dey registered for eligibility for di military draft as soon as December, to end long decades of self-registration.

Dis new rule wey one govment agency dey propose, go make dem fit register men automatically, no need for dem to do am by demsefs within 30 days afta dia 18th birthday.

Supporters of dis plan tok say automatic registration go save govment millions of dollars wey dem dey spend evri year to remind pipo wey dey eligible to register say registration dey required by law for men between 18 and 25.

Di rule still dey under review and dem gatz approve am bifor dem go fit implement am, though e don cause fear of mandatory US conscription in di event of a crisis.

Di Last time US military draft take place na 1973 afta years of massive opposition during di Vietnam War.

Di govment agency, Selective Service System (SSS) submit di proposal to di Office of Information and Regulatory Affairs on 30 March, according to di office website.

Di SSS website tok say di change go "transfer registration from individual men to SSS" through integration wit oda federal data sources, which dem believe say go make di process dey "easier".

For US, most men wey dey between 18 and 25 already dey required to register. If dem fail to register, na crime dem don commit, e fit carry five years for federal prison.

Even though prison sentence no dey exist, if you no register e fit make you no dey eligible for federal student financial aid or federal jobs.

Non-citizens wey no register fit no collect US citizenship.

Majority of US states and territories also dey register men automatically for selective service wen dem dey issue driver's license.

Despite all di rules, compliance bin drop to 81% for 2024, according to govment data.

Di new change for automatic registration get Congress approval for December as part of National Defense Authorization Act, wey dey authorise funding for US military and dia operations all ova di world.

Pennsylvania Democratic Representative Chrissy Houlahan, wey sponsor di language, tok say di move go allow govment to "rededicate resources".

"Basically e mean say money, towards readiness and mobilization," Military Times quote Houlahan. "Rather dan towards education and advertsing campaign wey dey push pipo to register."

Di change however prompt fear among some Americans say US dey towards military draft if di war wit Iran escalate or crisis break out for future.

White House Press Secretary Karoline Leavitt directly address di question on di draft and di possibility of US troops on di ground for Iran during interview wit Fox News for early March.

"E no dey part of di current plan right now, but di president dey keep di options on di table," Leavitt respond. "No greater priority or responsibility to dis president dan, of course, to protect di American pipo and our troops."

US govment don implement wartime draft six times for di kontri history, di most recent na during di Vietnam War.

Approximately dem draft 1.8 million Americans during di war, wey ultimately lead to di creation of all-volunteer military for 1973. President Jimmy Carter bin bring selective service registration back for 1980.