Terrorists kpai Brigadier General Oseni Braimah as Nigerian Army confam deaths of sojas for Borno

    • Author, Tunde Ososanya
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 4 mins

Di Brigade Commander of di 29 Task Force Brigade wey dey operate under Operation Hadin Kai, Brigadier General Oseni Braimah, don die during terrorist attack for one military installation on Thursday 9 April for Benisheikh, Kaga Local Govment Area of Borno State, north-east Nigeria.

One community leader, Zanna Lawan Ajimi, tell di BBC say Brigadier Braimah dey among sojas wey di terrorist kpai.

"E kpai for di attack. We confam dat from military sources and members of our civilian JTF wey also fight back di insurgents during di attack. One civilian also die, and one sustain injury," Ajimi tok.

"In fact, dem attack Benisheikh and Ngamdu, both communities dey under Kaga Local Govment. Especially for Ngamdu, dem kill many of di terrorists."

Meanwhile, for one statement wey di Director of Defence Media Operations, Major General Michael Onoja, sign on Thursday 9 April, di incident happun around 12:30 am for di Brigade Headquarters for Benisheikh.

E say troops of di Nigerian Armed Forces repel one coordinated terrorist attack on one military installation for Borno State.

Major General Onoja say di terrorists bin attempt to breach di facility defensive perimeter, and add say sojas of di 29 Task Force Brigade bin respond wit wetin e describe as "exceptional courage, professionalism and superior firepower", and force di terrorists to retreat.

E say na Brigadier General Braimah bin lead di counteroffensive as troops mount swift and coordinated response wey e say make di insurgents "abandon dia mission and leave behind traces of dia failed assault".

"Regrettably, di encounter bin result in di loss of a few brave and gallant sojas wey bin pay di supreme price for di line of duty," e tok.

Major General Onoja no confam di identities and number sojas wey die. E say: "In line wit established military tradition and respect for di fallen, di general public and media dey kindly requested to allow di Armed Forces to formally notify di next of kin bifor di release of further details."

"Di public also dey urged to disregard misinformation, sensational reports, and unverified content wey dey circulate across social media platforms, as dis dey undermine ongoing operations and national security efforts," e tok.

Major General Onoja say di attack na indication of di desperation of terrorist elements wey don suffer ogbonge losses for recent operations and continue to resort to futile and ill-fated offensives against well-defended military positions.

No group don claim responsibility for di attack.

Last November, di Islamic State West Africa Province bin kpai Brigadier General Musa Uba.

Bifor di killing of Brigadier General Braimah, di most senior Nigerian military officer wey go die for terrorist attack since 2021 na Brigadier General Uba.

Jihadist groups, including Boko Haram and Iswap dey target military bases for north-eastern Nigeria. Borno State na di centre of di insurgency for more dan10 years.

Although di violence for Borno bin reduce since im peak around 2015, attacks don increase in recent months.

Last month, series of suicide bombings for Maiduguri, di state capital, kpai more dan 20 pipo and injure many odas, and dis raise fresh concerns about security for di region.

Di United States, wey don step up security cooperation wit Nigeria, don advise dia citizens to reconsider travel to di kontri, and dem cite risks including terrorism, civil unrest and kidnapping. Borno State dey among areas under dia highest-level travel warning, wey dey advise against all travels.

Additional reporting by Makuochi Okafor