You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why di US govment tell staff for dia Abuja embassy to comot, list 23 states for Nigeria as 'Do Not Travel'
Di US govment don authorise all dia non-emergency employees and dia families to comot from dia embassy for Abuja sake of security situation wey dem say dey get worse.
Dis directive come on Wednesday, 8 April, 2026 from di Department of State, according to updated security and travel advisory wey di embassy release.
Also, for di new travel advisory, dem warn any American citizen wey dey plan to travel to Nigeria to reconsider, "sake of crime, terrorism, unrest, kidnapping, and inconsistent availability of health care services".
Dem also categorise 23 out of di 36 states of Nigeria as "do not travel".
"Violent crime dey common throughout Nigeria," di embassy tok for di. travel advisory wey dem publish for dia website.
"Dis include armed robbery, assault, carjacking, kidnapping, hostage-taking, roadside banditry, and rape.
"Kidnappings for ransom dey happen often (and) dey primarily target dual national citizens wey dey visit Nigeria. Kidnapping gangs bin don stop drivers for interstate roads to rob and kidnap victims."
Di embassy add say gangs dey normally target Americans sake of say dem dey perceived as pipo wey get money.
Anoda reason why di US embassy for Nigeria dey tell dia pipo make dem no travel to di kontri na sake of terrorism wey continue to be strong challenge.
Last month, suicide bombers carry out attack for di heart of Maiduguri, capital of Borno State for di northeast region of Nigeria, killing more dan 20 pipo.
"Terrorists dey continue to plot and carry out attacks for Nigeria. Dem dey collaborate wit local gangs to expand dia reach, and dem fit attack wit little or no warning," di embassy tok.
Target areas for attacks include shopping centers, malls, markets, hotels, places of worship, restaurants and bars, schools, government buildings, transportation hubs, and public places wia crowds dey gather.
Also, di healthcare system for Nigeria, according to di embassy, no dey well equipped and many of dem no get common medicines for diabetes or asthma, for example.
"Americans no fit expect di same level of health care to be available for Nigeria as dey dey for di United States. Nigerian medical facilities generally no dey equipped to U.S. or European standards," di advisory tok.
E kontinu: "Counterfeit pharmaceuticals na common problem. Hospitals dey often expect immediate cash payment for health services. Emergency services like e dey for di United States or Europe no dey exist. Blood supply dey often unreliable. Ambulance services no dey reliable, dem get poor equipment, and dey often no dey get trained paramedics."
For di pipo wey e really dey necessary. say dem must travel to Nigeria, di embassy advise dem to bring enuf over di counter and prescription medicines wey go last dem truout dia stay for di kontri.
"Make sure all your vaccinations dey up to date. Consider getting boosters for yellow fever, meningitis, typhoid, cholera, hepatitis A, hepatitis B, and polio. All visitors suppose take Malaria prophylaxis (bicos) Nigeria na high risk for Malaria."
Rising insecurity in Nigeria
For di updated US embassy travel advisory for Nigeria, dem name 23 states for di kontri as 'do not travel'. Di states na:
Abia, Adamawa, Anambra, Bauchi, Bayelsa, Borno, Delta, Enugu, Gombe, Imo, Jigawa, Kaduna, Kano, Katsina, Kogi, Kwara, Niger, Plateau, Rivers (except Port Harcourt), Sokoto, Taraba, Yobe, and Zamfara states, "sake of unrest, crime, and kidnapping".
Nigeria kontinu to dey battle wit plenty security challenges for almost all ova di kontri, from terrorism and insurgency for di northeast region, to banditry for di northwest and parts of di north-central.
E also get di issue of farmers and herdsmen wahala wey don turn into inter-tribal bloody attacks for plenty of di middle belt region like Plateau, Benue, and Nasarawa States.
On Sunday, March 29, 2026, more dan 30 pipo kpai wen armed men oppen fire on top civilians for Angwan Rukuba community for Jos North local govment area of Plateau State.
Also, religion-related attacks don dey recorded for various parts of northern Nigeria recently. Di latest na on Easter Sunday, 5 April, 2026, wen gunmen attack Christian worshippers for Banue, Kaduna and Katsina states, killing more dan 16 pipo and kidnapping plenty odas.
For di southeast region, violent activities by separatists groups also dey on di rise, despite di capture and prosecution of one of di leading separatist leader Nnamdi Kanu, who di Nigeri govment accuse of terrorism and sentence am to life imprisonment.
Di oil-rich south-south region of Nigeria also dey suffer from illegal activities by militant activists, oil theft and sea piracy, while for di southwest, thuggery and kidnapping for ransom dey usuall hapun.
President Bola Tinubu don promise plenty times say im govment go take steps to make sure say di security situation for Nigeria improve, but sabi pipo say di mata be like say e dey get worse.