Ghana authorities go begin repatriation of 'final batch' of 900 citizens from South Africa on 25 July

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
Ghana authorities don announce say dem go begin di 'final batch' of repatriation of dia citizens from South Africa on 25 July as anti-immigration protests continue.
Dis dey follow earlier evacuation of nearly 1,000 pipo from di rainbow kontri for early June, due to xenophobic attacks and harassment against African nationals.
Ghana be one of di first kontris wey begin to repatriate dia citizens afta fresh wave of attacks. Nigeria, Zimbabwe, Malawi, Ethiopia, Kenya and oda kontris also repatriate dia citizens from di kontri.
South African authorities bin deny say dia kontri be xenophobic wey dem explain say dem dey enforce dia immigration laws.
Dem announce say since di enforcement of dis immigration laws, dem deport ova 53,000 foreigners wey neva get legal documents to stay for di kontri.
Dem maintain say most of di affected African nationals bin either stay for South Africa illegally or dia documents don expire.
Vigilantes and anti-immigration groups bin accuse African nationals say dem dey collect dia jobs wey dem dey involved for criminal activities, allegations dis African kontris don deny.
Inside one fresh release, di Ghana High Commission for South Africa say di citizens wey already register wey dem undergo di screening process, be dose wey dem go begin to repatriate on 25 July.

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY
Details of dis repatriation of 900 pipo and wetin di citizens gatz know
Ghana High Commissioner to South Africa Benjamin Quashie announce say "di Ghana govment through di foreign ministry don provide support to repatriate anoda set of 900 citizens wey bin register to voluntarily comot dis kontri".
Im add say "we want announce to dose Ghanaians wey bin dey lodge for churches, hotels and oda places say we go begin di final batch of evacuation for 25 July. Di process for dis one go dey di same as di ones we don do for di past".
Oga Quashie say "we go dey visit you for di churches, hotels and oda places to tok to you about di process and how tins go dey afta di South Africa Home Affairs and border management pipo bin confam di 25 July as di start of di repatriation".
Di High Commissioner outline some of di tins dem go do ahead of 25 July.
- We go provide transportation for groups wey dey comot different provinces of di kontri
- We no dey do fresh registration of pipo at dis time
- Di repatriation be for citizens wey already bin register and finish di screening process
- If you neva register and do di screening, make you no come di High Commission or airport to create wahala for us
- From 25 July, pipo go dey assigned to specific flights wey we go notify dem about di date and time for each of di batches and wen dem gatz assemble for di High Commission.
- Dis go be di final phase of repatriation by di Ghana govment
- Any further call for repatriation afta dis go dey on case-by-case basis, wen authorities go make special case to govment

Wia dis foto come from, GHANA HIGH COMMISSION IN SOUTH AFRICA
If dis new batch of 900 citizens return successfully, e go shoot di number of repatriated citizens to nearly 2000.
For di vigilante groups and anti-immigration protesters, dem go continue dia demonstration every Thursday until di South African authorities fix di immigration, unemployment and crime issues for di kontri.










