Police go arraign Adeniyi Adeyemi ova alleged fake agency PFIPC

Adeniyi Adeyemi

Wia dis foto come from, PRINCE ADENIYI ADEYEMI/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Prince Adeniyi Adeyemi
Published
Read am in 4 mins

Nigeria Police Force say dem go arraign Adeniyi Adeyemi wey present imsef as di Director-General of PFIPC on Tuesday, for one case wey authorities describe as forgery, impersonation and oda related offences.

Di planned arraignment dey come afta police complete investigation into allegations say di suspect unlawfully assume di identity and office of di agency Director-General, allegedly carrying out official duties and making representations witout lawful authority.

Police sources say dem go charge di suspect bifor one competent court, wia prosecution go present evidence to support di allegations.

Di case don attract public attention sake of concerns about di integrity of public institutions and di need to protect govment agencies from impersonation and fraud.

Police don repeat say dem remain committed to make sure say anybodi wey break di law face prosecution according to due process. Dem also advise members of di public say make dem ignore anybodi wey no get authority but dey claim official positions.

President Bola Tinubu bin earlier direct relevant investigative agencies make dem investigate di circumstances surrounding di activities of di council as part of efforts to strengthen transparency and accountability for public institutions.

Wetin go happun for Tuesday court proceedings go determine di next stage of di criminal trial.

Brief background

On Wednesday, 1 July 2026, presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga accuse Adeyemi say e use fake documents wit forged signatures and seals, to dey claim leadership appointment for office wey no dey exist.

E also tok say police don chook eye for di mata and dem establish say di agency wey Adeyemi claim say e be di DG na fake, and say di man bin forge im appointment letter plus oda documents wey police recova from im house and office.

"Di case of Prince Adeniyi Adeyemi Matthew na clear case of con artist wey don build web of false claims to deceive unsuspecting govment officials and di public into playing by im scam book," Onanuga tok for im statement.

"For November 2016, im (Adeyemi) bin parade imsef as ambassador and President-General of di World Youth Organisation (WYO), wey be affiliate of di United Nations (UN)... Di local media bin dey celebrate am until di UN later deny say such a bodi exist," di presidential tok-tok pesin add.

However, Adeyemi bin don deny di allegation wey both Onanuga and Gbajabiamila dey put on im head.

For statement wey e release on 26 June 2026, e claim say e get documents to show say true-true Presido Tinubu give am appointment.

Adeyemi tok say di PFIPC wia e be Director General get account wit di Central Bank of Nigeria (CBN), and di govment bin allocate money to dem for di 2026 budget.

"Make we assume for one second say evritin wey di Chief of Staff publish na true, say di agency no dey exist. Den how di agency name take enta di 2026 appropriation budget for pages 50 and 51?" e ask.

"Dis issue no longer be about personalities. Na about contradictions wey demand answers," e tok.

Adeyemi call on President Tinubu to set up independent investigation to torchlight di mata between am and Gbajabiamila.

"Di purpose na clarity: no be denial versus counter-denial. If I dey wrong, let di independent process prove am. If Honourable Femi Gbajabiamila dey right, make dem confam am," e tok.

BBC News Pidgin check di website of di Budget Office of di Federation and we see true-true say di PFIPC get budget allocation and dia name appear for page 50 and 51 of di 2026 budget.