Okowa, Govnor Abiodun, Senator Nwoko, Jibrin - di big winners and losers for di APC primaries for Senate aspirants

Senatorial ticket winners

Wia dis foto come from, Senator Prince Ned Nwoko, Dr. Ifeanyi Arthur Okowa, Prince Dr. Dapo Abiodun - MFR, Senator Michael Opeyemi Bamidele, Senator Godswill Akpabio/Facebook

Published
Read am in 6 mins

Di All Progressives Congress (APC) don conclude dia primaries and winners wey go represent di party for di 2027 general elections don emerge.

Like di House of Reps APC primary wey bin hold on Saturday, 16 May, 2026, dis Senate primaries also throw up some surprise as some big names lose dia tickets while serving state govnors wey don complete dia second term, easily win.

Earlier on Monday, di APC bin release di list of aspirants wey dem say no pass di screening exercise, but dem again later edit dat list to comot some names.

Dis na how di exercise take go, di aspirants wey win big and di ones wey dey lick dia wounds:

Big winners

Govnors Dapo Abiodun and Hope Uzodinma: Dis two na heavyweights for di APC both for dia states and for di national level, so e for be ogbonge surprise if dem no win dia tickets.

Abiodun pick up di ticket for Ogun East Senatorial District, knocking out im predecessor, di past govnor of Ogun State, Gbenga Daniel, who be di current Senator representing dat particular senatorial district.

For di same manner, Uzodinma brush aside former Imo State govnor Rochas Okorocha to win di Imo West Senatorial ticket.

Oda sitting govnors wey also win dia tickets include Ahmadu Fintiri of Adamawa; Abdullahi Sule of Nasarawa; AbdulRahman AbdulRazaq of Kwara; Muhammad Inuwa Yahaya of Gombe and Mai Mala Buni of Yobe State.

Ifeanyi Okowa and Yahaya Bello: Okowa and Bello na di immediate past govnors of Delta and Kogi States respectively, and dem also win di tickets to represent dia respective senatorial districts namely: Delta North and Kogi Central.

For Okowa, e bin win anoda heavyweight, Ned Nwoko, wey dey currently occupy di seat, but for Bello, wey still dey ansa corruption gbege for court, im victory na easy one as e gada 72,399 to wipe im lesser known opponents, Ibrahim Adoje and Momoh Obaro.

Godswill Akpabio: Di Senate president anoda big name wey bin dey expected to win im ticket easily, and dat na exactly wetin happun as Akpabio emerge unopposed for im Akwa Ibom North West Senatorial District.

Shehu Sani: Afta e lose im Kaduna Central Senatorial District seat for di 2023 general elections sake of im quarrel dat time wit Govnor Nasir El-Rufai wey make am comot from di APC, oga Sani don regain di ticket as di tables don turn.

Philip Aduda - FCT: Aduda claim di APC ticket to run for di only Senate seat for di Federal Capital Territory unopposed.

Heavily supported by Nyesom Wike wey be di current FCT Minister - even though e no be member of APC - Aduda go try to regain di Senate seat wey e bin lose to Ireti Kingibe of di Labour Party for di 2023 general elections.

Im two opponent for di ticket, Abubakar Abdullahi and Usman Wowo, bin no make am pass di screening stage.

Oda big winners include: Senate Majority Leader Opeyemi Bamidele; former Abia State. Govnor, Orji Uzor Kalu; former Edo State Govnor Adams Oshiomhole and former Senate Majority Leader Ali Ndume.

Big losers

Ovie Omo-Agege surrounded by im supporters during di senatorial primary election for Delta State - Monday, 18 May, 2026

Wia dis foto come from, Ovie Omo-Agege/Facebook

Wetin we call dis foto, Former Senate President Ovie Omo-Agege (in white and black cap) dey claim victory for di election, even though local tori dey report say e lose.

Ovie Omo-Agege: Di former Deputy Senate President chop L for di contest as di sitting Senator Eda Dafinone wipe am wit 116,252 votes to 3,643, according to results wey di APC leadership approve.

However, Omo-Agege release statement for im social media handles wia e dey claim victory and dey tank im pipo for voting for am.

"Based on collated results from all 85 wards across our 8 Local Govment Areas, we don win decisively. Across di senatorial district, long open secret balloting queues bin stand in my favour, reflecting your overwhelming mandate and commitment to our shared vision for Delta Central and di APC," Omo-Agege write.

Even dis Tuesday morning, di former deputy Senate president also post anoda picture of im and supporters wey dey hail am, and e write: "Thank You! Thank You!! Thank You!!!"

Ben Murray Bruce: Di "common sense" senator lose im attempt to return to di Senate wia e bin represent Bayelsa East Senatorial District between 2015 and 2019.

Di APC bin include Bruce name for di names of aspirants wey no pass screening, but dem later withdraw dat list and publish anoda one wey im name no dey inside.

However, e no stop am from collecting big L for di election wey di winner na Israel Sunny-Goli.

Ned Nwoko: Di incumbent Delta North Senator lose im ticket to former govnor Ifeanyi Okowa by big margin; 113,039 votes to 2,612.

Tori be say Nwoko - wey dey always dey for di news for different reasons - no get di backing of di Delta State Govnor Sheriff Oborevwori.

Neda Imasuen and Osagie Ize-Iyamu: Imasuen na di current senator for Edo South. Senatorial District and e bin win di seat as member of di Labour Party, but e later decamp to join di APC.

Ize-Iyamu, on di oda hand na former govnorship candidate for Edo State and big chieftain of di APC.

However, di two aspirants lose di ticket to Omoregie Ogbeide-Ihama, wey be former member of di House of Representatives.

Ipalibo Banigo-Harry: Di former Rivers State Deputy govnor na di current senator wey dey represent Rivers West Senatorial District, but e surprise evribodi wen her name appear for list of aspirants wey no even pass di APC screening.

She describe di situation as "injustice to women" and she maintain say she dey qualified to contest.

"I be serving senator. I deserve to dey cleared," she tok. And she also tok say she go appeal directly to President Bola Tinubu and di APC National exco.

"I believe say our President dey gender sensitive. E don consistently advocate say make dem give women wey dey qualified chance to run for office."

Tein Jack-Rich: E also follow for di aspirants wey bin no pass di APC screening for senatorial aspirants for Rivers State.

Di development also surprise pipo bicos e bin don run as aspirant for di presidential candidate ticket for di APC for di 2023 election primaries, but e later step down.

Gbenga Daniel and Rochas Okorocha: Dis two former govnors of Ogun and Imo states respectively bin find demsefs competing against current govnors of dia states, Dapo Abiodun and Hope Uzodinma.

And wit di kain power wey sitting govnors get for Nigeria politics, especially for di APC wia President Tinubu publicly announce say govnors go get big say in determining who go get di party ticket, e dey almost impossible for di two to win.

Tori be say Gbenga Daniel bin withdraw from di race as e allege say plans dey to rain violence ontop im supporters.