Pictures from burial of Brigadier General Oseni Braimah and oda sojas wey Boko Haram kpai

Military officers carry body of slain soja

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Read am in 4 mins

Di Nigerian Army don bury Brigadier General Oseni Braimah and oda sojas wey kpai for di recent insurgents attack for Borno State.

Di burial ceremony hapun for di Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri, wia dem bury di officers and sojas wey dem honour wit full military rites.

Ogbonge pipo like di Govnor of Borno State, Professor Babagana Umara Zulum, Minister of Defence, General Christopher Musa (Rtd), Chief of Defence Staff, Chief of Army Staff and oda senior military officers, showface for di ceremony to honour dem.

Dem call on evribody to join di fight against insurgency for di kontri as dem pledge to end di insecurity problem for di northeastern Nigeria.

Dem kill some of di personnel on April 9 wen suspected fighters of Boko Haram and di Islamic State West Africa Province bin carry out coordinated attacks on military formations for Benisheikh, one town for Kaga Local govment Area along di Maiduguri–Damaturu highway.

Foto of casket wey dem cover wit Nigeria flag

Wia dis foto come from, Nigerian Army

'We go do evritin to reverse dis trend' - Govnor Zulum

Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, Govnor of Borno State, Babagana Zulum, Minister of Defence, Gen Christopher Musa (rtd)

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Wetin we call dis foto, Cross section of ogbonge pipo for Nigeria security wey show face for di burial.
Nigerian Army Officers stand for cemetry dey salute as deadibody of one of di sojas wey kpai dey for ground, dem wrap am wit Nigeria flag of green and white.

Wia dis foto come from, Nigerian Army

For dia tributes, di Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede say dia death signify courage, commitment wey no dey shake in line of duty or adversity against di pipo wey wan undermine di security of our dear nation.

"Dis men answer di call of patriotism and dia loss don strengthen our determination to end terrorism and restore lasting peace for all di regions wey dey affected."

Im tok say na di collective duty of evribody to uphold dis mission and uphold di process we dem don make so far.

"Di Nigeria Army don lose a Commander but Nigeria lose a patriot and all di oda sojas wey dey rest hia today na backbone of our operation, dem be di young men wey comot from dia mama and papa house, leave dia pregnant wives and small pikin dem, dia dreams of peaceful retirement go di harsh terrain of di northeast.

Long nights, di ambush dem, di uncertainties to make sure say farmers fit go back to farm and pipo fit sleep without fear " na wetin di Minister of Defence Christopher Musa tok for di burial.

Im add say dis fallen sojas no ask for glory but opportunity to serve dia kontri wey dem do until dem kpai.

E console di families as e tok say no mata wetin im tok , e no go fit replace di sojas wey don kpai in line of service.

Govnor of Borno State, Babagana Zulum, tok say "recently di insurgents don adopt a trend to kill commanding officers and odas, dis na deliberate attempt to kill di morale of our officers and men and we go do evritin to reverse di trend. "

Govnor Babagana add say di worse don hapun and e don end sake of say dem don witness plenti sad events for Borno State but e no dey possible to question God.

Pipo gada dey look caskets wey dem cover wit Nigeria flag we dey for ground

Wia dis foto come from, Nigerian Army

For di solemn and emotional ceremony, wey families of di fallen heros, dia loved ones and oda pipo attend, dem give di military officers honours sake of dia selfless service and commitment to defend di nation.

Di Nigerian Army for dia Facebook page say "di sacrifice na reminder of di heavy price wey members of di Armed Forces dey pay daily to safeguard di peace, unity and security of Nigeria."

"As di nation dey mourn dis heroes, e dey remind us say di freedom and stability wey we dey enjoy today dey come at high cost, wey brave men wey place duty above self and wey dey also give evritin in service to dia fatherland dey face."

Nigeria dey suffer from insecurity for di northeast for many years and security pipo still dey find wey to end di trend.