Tyson Fury and Anthony Joshua heavyweight clash set for December in Cardiff

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Kal Sajad
- Role, BBC Sport boxing journalist
- Published
- Read am in 4 mins
Anthony Joshua and Tyson Fury go contest dia long-awaited all-British heavyweight fight for Cardiff Principality Stadium on 11 December.
Dem go show di fight, wey take more dan a decade in preparation globally on Netflix.
BBC Sport understand say di main event go happun for di early hours of Saturday morning for UK, as organisers no go start early to cater for audiences for di United States.
Joshua and Fury go show face-to-face for one news conference for London on Wednesday, 30 September, as di build-up start to one of di most anticipated fights for British boxing history.
"I dey inspire a generation," 36-year-old Joshua, post on Instagram.
Fury, wey be 38, neva comment on di announcement.
Dem dey promote di event as a collaboration between Saudi boxing powerbroker Turki Alalshikh's The Ring and UFC chief Dana White.
"Two of di best heavyweights of dis generation, finally for di ring togeda," Alalshikh tok.
"Dis go be one of di biggest fights in boxing history. I dey very happy to make dis fight happun for di fans."
Di former two-time world champions don already sign di contracts for di fight earlier dis year, but dem neva confam di date and venue yet.
Tyson and Joshua fight venue, time and tickets
London Wembley Stadium and New York Madison Square Garden bin dey di frontrunners to stage di fight, but two of dem present dia issues.
Dem come finally arrive at Cardiff as di alternative.
Di Cardiff Principality Stadium don host late-night boxing bifor, including Joe Calzaghe fight wit Mikkel Kessler for November 2007.
Welsh Rugby Union and Cardiff Council officials welcome Tyson and Joshua fight, say e go reinforce di city reputation for staging major events and fit bring significant economic boost.
But dem go still need to finalise some operational details.
Joshua don dey push for di fight to take place infor di UK and e don get im wish.
"Foreva indebted to di UK public for dia support of Anthony Joshua. We no fit get dis ova di line witout you," im promoter Eddie Hearn say.
Major fight for Cardiff to take place for di early hours fit dey unusual, but e get past UK events wey don schedule around American television audiences.
Di precise timing of Fury-Joshua neva dey announced yet and promoter Eddie Hearn say suggestions show say e fit begin as late as 03:00 GMT.
Ringwalk around 01:00 or 02:00 GMT go place di fight at 20:00 or 21:00 respectively on di US east coast.
Why Tyson Fury clash wit Anthony Joshua matta
For years, British boxing don dey debate who go win, dem watch negotiations collapse and wonder weda Fury and Joshua go eva actually share a ring.
Now, finally, date and venue don set and di fight go happun.
For 2020, di two camps agree di basis of two-fight deal. For 2021, contracts dey signed for undisputed heavyweight contest, only for Deontay Wilder successful arbitration case to force Fury into third fight wit di American.
Den, for 2022, Joshua accept 60-40 split to challenge Fury, but dat attempt also fall apart.
Joshua get di British fight e want, organisers give stadium capable of staging huge event for December and broadcasters fit tailor am towards American audiences.
Wetin matta most for supporters na say Fury-Joshua go happen for Britain. E get some fights wey dey more dan dan purses, broadcast deals and site fees- dis na one of dem.
British fans don follow evri twist: di world-title win, di defeats, di comebacks, di rivalries and, above all, di failed attempts to make dis contest.
Now dem go get di chance to travel to Wales and say dem come here too.
Tens of thousands go descend on di Principality Stadium for wetin go be one of di biggest nights British boxing don eva stage in years.
DI fight fit don arrive years later dan many want am but Fury-Joshua fit still leave dat kain of legacy.



















