Sri Lanka court find 15 men guilty for deadly Easter Sunday bombings wey kill 270 pipo

Armed men carry gun
Published
Read am in 3 mins

Sri Lanka High Court don convict 15 men wey dem charge say dem plot di 2019 Easter Sunday bomb attacks.

Dat attack lead to di killing of 270 pipo and injure more dan 500.

Among dose wey dem find guilty include Naufer Moulavi, wey prosecutors say na im dey behind suicide bombings.

Court allow nine pipo to go afta dem acquit dem.

Di co-ordinated blasts wey happun for three churches and three luxury hotels dey among di deadliest for Sri Lanka since di end of dia civil war for 2009..

Amond di pipo wey die for dat East bombings na forty-five foreigners.

All di bombers wey carry out di attacks die for di blasts.

Investigators don previously blame di bombings on Islamist extremists, and di 25 men wey dem charge na from Sri Lanka Muslim minority.

One of di accused pesin die for custody.

Di accused pipo bin chop charges wey dey more dan 23,000 offences, including murder, conspiracy to commit terrorism and possessing firearms.

More dan 2,300 pipo give evidence for di prosecution.

During di court proceedings, dem also get 2,076 piece of evidence, wey include explosives, swords and firearms.

For di bombing attacks, Sri Lankan authorities point to "major intelligence lapse". Dia parliament hear say tip-off from India about di attacks no dey properly shared wit di authorities.

For 2023, di Supreme Court order former president Maithripala Sirisena to pay millions in compensation to di victims of di bombings, afta dem find say e dey responsible for national security failures wey lead to di attacks.

Last month, two former senior officials chop sentencing to death for criminal negligence wey lead to di bombings.

Death sentences dey usually change to life in prison for Sri Lanka sake of dia decades-old pause on executions.

For years, Sri Lankans dey hold regular demonstrations to demand justice for di victims of di Easter attacks.