Nigerian Air Force release names of crew members and passengers wey die for Ondo State plane crash

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigerian Air Force don release di names of five crew members and 20 passengers wey lost dia lives for di 931 aircraft accident wey happun for Igbokoda area of Ondo State, southwest Nigeria on Monday, 5 October.
Di Air Force for inside one statement on Tuesday wey dia tok-tok pesin Air Commodore Ehimen Ejodame issue on Tuesday tok say dem neva see any survivors from di ATR 42 aircraft, NAF 931 wey crash near one naval base area for di state.
Di statement say di aircraft bin dey on one routine mission from Benin to Lagos wen di accident occur.
"Dem immediately activate search-and-rescue procedures, wit response efforts in coordination wit relevant authorities to locate and account for all persons on board. No survivors have been found," NAF tok for di statement.
Although, di cause of di accident neva dey clear, however, di Chief of di Air Staff (CAS), Air Marshal Sunday Kelvin Aneke wey describe di incident as "painful moment for di Nigerian Air Force and di nation", tok say im don direct comprehensive investigation to establish di circumstances wey surround di accident.
E also assure families of di victims of di service full support during dis difficult period.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who be di victims
Crew
1. Squadron Leader MI Aburime - (Flight Captain)
End of Di one wey oda users dey read well well
2. Squadron Leader AP Man-Ugwueje - (Co-pilot)
3. Flight Lieutenant IS Bako - (Co-pilot)
4. Warrant Officer Abubakar A - (Aircraft Technician)
5. Corporal Uguru HC - (Aircraft Technician)
Passengers
6. Flight Lieutenant - TL Lazarus
7. Flight Lieutenant - M Akinloye
8. Flying Officer IM - Adeshina
9. Master Warrant Officer - Onwuka F
10. Master Warrant Officer - Matini BA
11. Warrant Officer - Nuhu FS
12. Flight Sergeant - James RB
13. Flight Sergeant - Mohammed AI
14. Sergeant - Ani AE
15. Sergeant - Izibenikien SI
16. Sergeant - Alafuka C
17. Sergeant Mbadugha - AN
18. Lance Corporal - Ugwuba FC
19. Lance Corporal - Eledan GE
20. Ezeh Nneka
21. Godstmine Tarabina
22. Joy Micheal
23. Sunday Micheal
24. Ukeme David
25. Gideon Omotola

Earlier, di presidency bin tok say na 32 pipo die on board di aircraft.
According to di Aviation Minister Festus Keyamo, preliminary information suggest say na 25 passengers and 7 crew members bin dey on board di aircraft.
E add say even though di control and regulation of military aircraft dey completely outside di authority of di Ministry of Aviation, and Civil Aviation Authority, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke don pledge dia total cooperation and assistance for di search and rescue efforts wey dey go on.
Di crashed plane, wey authorities describe as ATR-42 aircraft, dey carry between 30 and 50 passengers, according to dia manufacturers.
Di Nigerian Air Force dey play ogbonge role for di kontri military operations, wey include efforts to tackle armed groups and insecurity for several parts of di kontri.





















