Tinubu go receive Certificate of Return afta e win APC presidential primaries

Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nigeria presidency

Published
Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu go collect im Certificate of Return on Sunday afta im win di All Progressives Congress presidential primary.

One of im tok-tok pipo Bayo Onanuga, wey be Tinubu senior special adviser on information and strategy, post for im X handle say di president go collect i certificate of return and di party flag on Sunday May 24.

"President Bola Ahmed Tinubu go on Sunday receive di certificate and flag of di All Progressives Congress (APC) as di presidential candidate for di 2027 elections.

"Di Presidential Primary Elections Committee go present di certificate and flag for di Bola Ahmed Tinubu International Conference Centre for Abuja afta nationwide collation of di primary election results.

"APC governors, members of di National Executive Committee, di National Working Committee, and di National Assembly, along wit party stalwarts, go attend di event." im tok

Nigeria President, Bola Tinubu

Wia dis foto come from, (Photo by Nigerian Presidency / Handout/Anadolu via Getty Images)

President Bola Tinubu record beta victory across several states as di All Progressives Congress (APC) bin do dia 2026 presidential primary election on Saturday.

Di exercise, wey hot well-well hapun for most states on Saturday afternoon. Na APC some APC govnors serve as collation officers.

For many of di results, President Bola Tinubu beat Stanley Osifo, wey be im only challenger lone challenger hands down. Tori be say for some states, Stanley Usifo no get any vote.

How di results waka

For Rivers State, Tinubu get 280,468 votes, while Osifo get zero votes across di 23 LGAs of di state, according to Siminalayi Fubara, governor of di state.

For Edo State Tinubu get 131,096 votes, while Osifo get one vote during di election.

for di 192 wards for di state on Saturday.

Monday Okpebholo, wey be di govnor and returning officer for di election, say di exercise dey peaceful and transparent.

For Gombe, Muhammadu Yahaya, governor of Gombe, say APC deliver evri vote to Tinubu during di presidential primary wey hapun across di 11 LGAs.

Yahaya say Tinubu get 450,516 votes while Osifo get zero votes, im say di state get 550,516 registered APC members.

For Osun, Tinubu sweep di polls wit 100,880 votes for di primary. Adegboyega Oyetola, minister of marine and blue economy, na im serve as di collation officer.

For Ebonyi, Oga Tinubu win all 207,579 valid votes cast across di 13 LGAs, while im rival get zero votes.

Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi and collation officer for di state, say voting hapun di same time across 171 wards and 13 LGAs, wia di party get 215,490 members.

For Kwara, Tinubu also wipe Osifo, e poll 310,990 votes while Osifo no get any vote.

Abdulrahman AbdulRazaq, who wey announce di results, say na a total of 457,374 party members register, while dem accredit 310,990 members wey participate for di voting process across di state.

For Bayelsa Tinubu gada 277,192 votes to defeat Osifo, wey manage get only five votes, according to Doriel Nduwi, di collation officer.

For Zamfara, Tinubu get 321,579 votes against di 42 votes wey Osifo get.

Dauda Lawal, govnor of di state, who announce di result, say a total of 322,435 accredited voters take part for di process.

Uba Sani, govnor of Kaduna monitor di primary across di 255 political wards for di 23 local govment areas, im tok say party members come out well-well to vote. exercise.

Meanwhile, some states don give President Tinubu assurance say evritin stew for am. Dem still dey wait for oda states to finish collation and announce results.