Wetin we know about di killings and kidnapping of worshippers for Kwara State by gunmen

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Kwara State Police Command don confam di killings and kidnapping of some worshippers by armed criminals for Ori-Oke Ajaiye, wey dey located for di outskirts of Ikiran Village, Ekiti Local Govment Area of Kwara State, north-central Nigeria.
According to di state police tok-tok pesin, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, na one Pastor Adebayo Abiodun of Ijo Ajaye Ati Igbala report di incident on Sunday, 24 May.
Di pastor say while while dem dey do night vigil on Saturday, 23 May around 10:30pm, armed hoodlums invade di prayer ground, fire guns wey kpai three pipo, and dem abduct fifteen odas to unknown destination.
"Upon receipt of di distress report, di Divisional Police Officer, Ekiti Division, immediately mobilise operatives to di scene.
"Di Commissioner of Police, Kwara State Command, CP Ojo Adekimi, psc, mnips, bin direct a comprehensive tactical and intelligence-driven operation wey involve Police Drone Team, PMF personnel, Intelligence Units, and oda operational assets for a coordinated rescue mission," di police tok.
Di Commissioner of Police describe di attack as barbaric, callous, and unacceptable, as e assure di families of di deceased, di pipo wey wound, and di victim wey dem kidnap say di Command dey fully committed to make sure say dem go rescue all of dem.
Police also give assurance say dem go arrest di gunmen wey dey responsible for di act.
"Di Command wish to assure residents of Ekiti LGA and di entire State say serious efforts dey go on, including bush combing, intelligence gathering, and coordinated security operations to track down di assailants and bring dem to justice.
"Make members of di public remain calm, vigilant, and supportive and make dem provide credible and timely information wey fit assist ongoing operations."
Dem promise to update kontri pipo on how di investigation dey waka.
Dis dey come afta gunmen kpai one mathematics teacher wey dem kidnap among seven oda teachers and schoolchildren for one school for Oriire Local Govment Area of Oyo State.
Inside one statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.










