How Ghana footballer Dominic Frimpong die inside late night armed robbery attack on team bus

Read am in 3 mins

Winger for one local league club for Ghana; Dominic Frimpong don die afta late night robbery attack.

Armed robbers bin attack di Berekum Chelsea FC team bus on dia way from one league match against Samartex for di Bibiani-Goaso road.

Di club confam afta midnight say "di group of armed robbers block di road wey masked men wey carry guns begin to shoot di bus."

"Di players and staff run enta bush to take cover during di attack, but one player bin sustain serious injury wey don dey receive medical attention," di club bin explain.

But di club winger Dominic Frimpong bin die from im injuries bifor daybreak.

Frimpong na player wey bin dey on loan from Aduana Stars FC – wey im score two goals in 13 games for Berekum Chelsea.

Di 20-year-old na promising star wey im death shock di football community for di kontri.

Di parent club of di player Aduana Stars inside dia official statement say "we dey heartbroken to learn about di death of Dominic Frimpong wey we bin loan to Berekum Chelsea."

"Dis be devastating loss to both clubs and football as a whole; we dey extend our condolence to Berekum Chelsea, di family of Dominic, im teammates and everibodi wey dey affected by dis tragedy," tok-tok pesin for Aduana Stars Evans Oppong tok.

Police dey investigate, Ghana football association chook mouth

Police say dem dey investigate di latest incident wey don raise concern about safety and security of travelling teams for di local league.

Di police for one statement say dem deploy crime scene experts to di area wey dem dey search for di suspects.

Sports analyst Michael Oti Adjei afta di incident say "di number of times players for di local league face attacks like dis at night be crazy."

He tok say tins for change; as dis no be di first time attack like dis dey happun.

"We neva for discuss football like dis, neva eva again."

Di Ghana football association (GFA) say dis incident "be big loss to Ghana football."

According to di association, Dominic Frimpong be "promising young talent wey be dedicated to di game wey im also get passion wey be di spirit of our league."

Di GFA say dem dey tok wit stakeholders to "review and strengthen security arrangement for clubs wey dey travel for domestic competitions to prevent such tragic incident for di future."

Di association say make "di football community unite to support Berekum Chelsea and di family of di player for dis moment of grief".

Oda clubs dey extend solidarity to di family of di 20-year-old striker and di club.

Kumasi Asante Kotoko SC tok say "our thoughts dey wit di players, technical team and management of Berekum Chelsea for dis difficult time. We urge di authorities to ensure safety and security of all club."

Accra Hearts of Oak Sporting Club also share dia solidarity wit Berekum Chelsea.

Dem tok say "no club, player or football official for eva endure such traumatic experience for di line of duty."

"We wish di odas wey injure speedy recovery," di club tok for dia statement.

Dis no be di first time local football teams dey face attacks like dis for fi kontri.

Legon Cities striker Osman Amadu bin injure wen armed robbers attack dia team bus for di Bibiani-Nkawie road for 2023.

For 2022, Ashanti Gold SC face robbery attack for dia team bus wen dem bin dey return to Obuasi afta dia league match wit Accra Hearts of Oak.

Armed robbers also attack Kumasi Asante Kotoko SC for 2015 for dia hotel ahead of one league game for Accra.

For 2019, armed robbers attack Asokwa Deportivo for dia team bus wey dem collect cash, phones and oda tins from di players for Jocobu.

Oda local league clubs for Africa also dey suffer dis kind attacks either on dia way to league center or wen dem bin dey comot di venue to dia home.

And dis no dey hapun only for Ghana.

For neighbouring Nigeria, local teams dey also face violence and robbery.

For 2023, hoodlums bin attack di team bus of Sunshine Stars FC for di Benin-Ore expressway, wey dem shoot one ball boy and injure di team manager and odas.

El-Kanemi Warriors also face armed robbery attack for di Jos-Bauchi road wey injure many players and officials wey bin dey return from one match against Ikorodu City.

Oda football teams for Africa dey suffer dis attacks wey dey affect football development for di continent.