Who be Mahmoud Sadis Buba?

Wia dis foto come from, ABIN AL'AJABI/INSTAGRAM
Mahmoud Sadis Buba, wey pipo sabi as "Abin Al'ajabi" (The wonder), na young man from Kaduna State wey don draw plenty attention afta e pass screening stage of All Progressives Congress (APC) for House of Representatives seat for Sabon Gari, Zaria, ahead of 2027 general elections.
Di politician draw public attention afta e appear bifor APC screening committee few days ago.
As e dey tok to BBC, Buba say e qualify for di position since e don pass di constitutional age wey be 25.
E also tok say im small bodi size, wey e inherit from im papa side grandpapa, no go affect im ability to serve for National Assembly.
According to am, na pipo from im constituency encourage am make e run becos of di work wey e dey do for di community.
E tok say im nickname start during im secondary school days from one of im teachers, Hajiya Binta, wey joke tell am say e deserve to dey call am "Abin Al'ajabi (The wonder)."
"Wen she tell me say dem suppose dey call me Abin Al'ajabi, I say no problem. She come say we go go meet di emir make dem officially give me di nickname."
Buba say im dwarfism neva ever worry am sake of say na how God create am and how God want make e be, and e dey see am as part of im livelihood.
"Na so God create me, and na so e want make I be. My condition never worry me; instead na sometin wey I dey proud of."
E add say some of di challenges wey e dey face na how some pipo dey mock im bodi.
"Some pipo, if dem no like you, dem go say, 'see as e short, e no get height.'"
E still explain say im dwarfism na sometin wey e inherit, trace am go im grandpapa for im papa side. According to am, im papa sef get similar condition, but e tall pass am small.
"I inherit dis dwarfism bicos my papa sef be like dat, but e tall pass me small. Most pipo wey sabi my grandfather well dey tok say I resemble am."
E tell BBC say e be former driver and now na chairman of support group for Bola Tinubu and Uba Sani for 2027.
"I don dey inside politics since long time, even from Buhari time. Now, anytime I fit go see di president."
For now, Mr Buba say local and state level positions no dey interest am bicos of di impact wey e don already dey make among pipo.
E add say if e get chance bicom member of House of Representatives, e go help pipo wey get disability by improving dia lives.
"Some pipo, bicos of how God create dem, dey use am spoil dia life or future through begging. If I get opportunity, we go stop dat and give dem skills."
E say wetin dey sweet am pass now na di support wey e dey get from pipo.
Abin Al'ajabi bin don take picture wit many big political figures, including President Bola Ahmed Tinubu, Vice President Kashim Shettima, Senate President Godswill Akpabio, and some govnors.
Who be Mahmoud Sadis Buba?
Mahmoud Sadis Buba dem born am for Zaria local govment for Kaduna.
And according to am, e be 30 years old. For inside one viral video during im screening, e tok say e be 30, though im body size make many pipo dey doubt am.
E come from Sabon Gari constituency for Zaria, Kaduna State, and na di first pikin among nine children.
E get dwarfism, wey e say e inherit from im grandfather for im papa side.
According to am, all im family dey stay for Zaria Local Govment Area of Kaduna State. E still dey take care of about 20 relatives and orphans for im house for Zaria.
Abin Al'ajabi say e be businessman bicos e get shops and motorcycles wey e dey give pipo for hire for im hometown.
Mahmoud Sadis Buba, wey dem also sabi as "Al-ajabin Zazzau," don collect im Expression of Interest and Nomination Forms to contest for House of Representatives seat wey represent Sabon Gari Federal Constituency for Kaduna State under APC.









