In fotos: How kontries across di world cross ova to 2024

Foto of woman wey wear 2024 eyeglass
Published

Most of di kontries around di world don enta di new year, and we done see some ogbonge firework displays for major cities as dem ring in di new year.

Kiribati, Di for di Pacific nation na di first to welcome 2024.

Kiribati occupy one ogbonge area for di equatorial Pacific - nearly 4,000km from east to west and more dan 2,000km from north to south.

Na New Zealand follow Kiribati.

New Zealand ring in 2024 at 11:00 GMT.

See di time some of di kontries enta new year below:

Kiritimati atoll in Kiribati - 10:00 GMT

New Zealand - 11:00 GMT

Australia east coast - 13:00 GMT

Japan and South Korea - 15:00 GMT

India and Sri Lanka - 18:30 GMT

Twenty-five countries including UK - 00:00 GMT

Brazil and Argentina 03:00 GMT

US east coast 05:00 GMT

And by di time di last place leave 2023 - Baker Island for di central Pacific Ocean - e go be 12:00 GMT.

By which time e go already be 2 January, 2024 for Kiribati.

Some ogbonge fotos from across di world as pipo mark di moment dem enta New Year

Fireworks as New Zealand welcome di new year
Wetin we call dis foto, Fireworks as New Zealand welcome di new year
Sydney fireworks
Wetin we call dis foto, Sydney fireworks
Sydney fireworks
Wetin we call dis foto, Sydney fireworks
Fireworks for London as dem ring in di new year
Wetin we call dis foto, Fireworks for London as dem ring in di new year
Fireworks for London as dem ring in di new year
Wetin we call dis foto, Fireworks for London as dem ring in di new year
Fireworks light up Arc De Triomphe for Paris, France
Wetin we call dis foto, Fireworks light up Arc De Triomphe for Paris, France
Church goers celebrate di new year for Nigeria
Wetin we call dis foto, Church goers celebrate di new year for Nigeria
Church goers celebrate new year for Kenya
Wetin we call dis foto, Church goers celebrate new year for Kenya
Fireworks light up Rio de Janeiro for Brazil
Wetin we call dis foto, Fireworks light up Rio de Janeiro for Brazil
For Norway, one couple celebrate di new year on top of Mount Floya for Tromso, beyond di Arctic Circle
Wetin we call dis foto, For Norway, one couple celebrate di new year on top of Mount Floya for Tromso, beyond di Arctic Circle
Dis na di view from Dallas as fireworks light up di city skyline for di celebrations
Wetin we call dis foto, Dis na di view from Dallas as fireworks light up di city skyline for di celebrations
Fireworks explode over di Grand Palace for Bangkok
Wetin we call dis foto, Fireworks explode over di Grand Palace for Bangkok
Fireworks for Hong Kong
Wetin we call dis foto, Fireworks for Hong Kong
Fireworks from Chile
Wetin we call dis foto, Fireworks from Chile