Black Panther: How people see di world premiere

Black Panther poster
Published
Read am in 2 mins

E be like say critics wey watch new Marvel superhero film, Black Panther, like wetin dem see.

Marvel Cinematic Universe do world premiere for dia first black superhero film for Los Angeles.

Chadwick Boseman
Wetin we call dis foto, Chadwick Boseman na Black Panther, a.k.a. T'Challa

Na Chadwick Boseman be di actor Black Panther and Michael B Jordan be boss Eric Killmonger.

Other stars wey dey inside di film na Lupita Nyong'o, Martin Freeman and Daniel Kaluuya.

Lupita Nyong'o

Na 13 February dem go release di film for cinema but people wey dia work na to dey chook eye for film mata gather to watch am on Monday night.

Some of dem don already dey talk dia mind as per how dem see dis new Marvel film.

Di actors for Black Panther dey for stage

Trevell Anderson for LA Times' talk say "na love letter about blackness".

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Freelance film writer Rebecca Theodore-Vachon say Black Panther "be everything wey I want and more sef".

Black Panther

Di film scatter di head of Mashable film writer Angie J Han.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

And Business Insider reporter, Jason Guerrasio, say di film "na di most spiritual film Marvel don do yet!"

Black Panther

Na for di film Captain America: Civil War wey Marvel first show di Black Panther character, wey im other name na T'Challa.

For di Black Panther film, T'Challa go back im country Wakanda to become king after im father die.