Saudi Arabia: Women dey hail as dem comot driving ban

Saudi activist Manal Al Sharif dey pose for inside car for Dubai
Published

Women and Campaigners for Saudi Arabia don hail di new decree wey King Salman bin Abdul Aziz Al Saud land wey allow women to drive for the first time.

One female activist talk say na "great victory", while another talk say things "no go be di same again".

Campaigner Sahar Nassif tell BBC say she begin jump up and down plus laugh wen she hear di good news.

"I go buy my dream car, wey be convertible Mustang, and e go be black and yellow!"

Fatimah Baeshen, wey be di first woman wey go be Saudi Arabia's spokesperson for di embassy for US, put for twitter say na "di right decision for di right time".

Di country appoint Baeshen a day after King Salman bring out royal decree wey go allow women to drive motor.

Di first woman spokesperson and women right to drive na important moment for Saudi history.
Wetin we call dis foto, Di first woman spokesperson and women right to drive na important moment for Saudi history.
Congratulation to all women wey fight di ban, Saudi Arabia don finally join di 20th century.
Wetin we call dis foto, Congratulation to all women wey fight di ban, Saudi Arabia don finally join di 20th century.
We don dey wait for dis to happen since.
Wetin we call dis foto, We don dey wait for dis to happen since.
Where all di sheikhs wey no want women to drive hide dia face today.
Wetin we call dis foto, Where all di sheikhs wey no want women to drive hide dia face today.
Saudi Arabia no go be di same again.
Wetin we call dis foto, Saudi Arabia no go be di same again.
One day motor go fall as rain and i go get my own key.
Wetin we call dis foto, One day motor go fall as rain and i go get my own key.
We start from di bottom and now we don reach here.
Wetin we call dis foto, We start from di bottom and now we don reach here.