I go sack Wenger if I buy Arsenal - Dangote

Aliko Dangote, Arsenal, Wenger

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dangote dey sure say e no go hard to convince Kroenke and Usmanov to sell
Published

Africa richest man, Aliko Dangote, fit sack Arsene Wenger if im plan to buy Arsenal Football Club succeed.

Di Nigerian billionaire say e don tay wey im don dey think of buying di English Premier League Club. Dangote say e don dey like to buy di club since mid-1980s wen e become dia supporter.

Speaking for one interview, Dangote say as soon as im finish to build di $11bn oil refinery wey im dey do for Lagos, Nigeria, di next thing to face na to buy Arsenal, come remove Wenger.

But some people don talk say e go hard for Dangote to buy Arsenal from American billionaire, Stan Kroenke, wey get 67% of di club and Russian billionaire, Alisher Usmanov, wey get 30%.

Arsenal, Dangote, Wenger

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wenger fit lose job if Dangote buy Arsenal

E be like say Dangote no dey worry about all that one. Im talk say Wenger don do very good job for Arsenal but e go good make another person come try im luck.

Wenger na di oldest club manager for the whole of Europe football; e don work for the club for 21 years now.