Stoke City don beat Arsenal for premier league

Jesse Rodriguez
Wetin we call dis foto, Stoke dey always worry Arsenal for home
Published

Former Real Madrid winger Jese Rodriguez don start im career for Stoke City well well as im score the winning goal against Arsenal.

Jese pick Saido Berahino pass come enter from tight angle, and as Arsenal defenders no mark am tight, na so e score.

Arsenal been think say dem don equalise when Alexandre Lacazette strike with 18 minutes to go, but linesman say na offside.

For other matches,

Swansea 0 Man Utd 4

Bournemouth 0 Watford 2

Burnley 0 West Brom 1

Leicester 2 Brighton 0

Liverpool 1 Crystal Palace 0

Southampton 3 West Ham 2

Romelu Lukaku
Wetin we call dis foto, Lukaku score again for Manchester United
Sadio Mane
Wetin we call dis foto, Senegal star Sadio Mane score for Liverpool
Alex Iwobi
Wetin we call dis foto, Alex Iwobi and Arsenal no dey like play Stoke