US neva comot Nigeria from list of 'country of particular concern' – here na wetin don happun so far

Wia dis foto come from, Ministry of Foreign Affairs/X
Di joinbodi working group betwin officials of di United States and Nigeria govment meet for Washington on Thursday as dem kontinu to chook mouth into di situation wey make di US govment declare Nigeria as kontri of particular concern.
Allison Hooker wey be di Under Secretary of State for Political Affairs for di US govment, and Nuhu Ribadu di National Security Adviser for Nigeria, na di head of di kontri delegation.
Dis meeting dey come just more dan two weeks afta anoda mass killing wey local residents insist say e dey religious motivated, for Naridon community of Kaduna State.
Thirty pipo - including at least seven children - die for dat midnight attack on 27 July 2026.
According to one press statement afta di joinbodi meeting on Thursday, di discussion bin centre on three major tins, "protecting Christian communities for Nigeria Middle Belt area, holding perpetrators of violence accountable, and military-to-military cooperation".
"Di JWG identify say challenges still dey kontinu, including reports of civilian fatalities and gaps for humanitarian expenditure transparency," di statement tok.
"Di two side agree say plenty work still dey to do especially as e concern support for IDPs."
Dis na di second meeting of dis joinbodi group. Di first one bin hapun for di Nigeria capital Abuja for January 22, dis year.
Di US govment sha neva comot Nigeria from di 'kontri of particular concern' list.
Dis joinbodi working group betwin di US and Nigeria bicom necessary afta di US President Donald Trump, for late October of 2025, declare Nigeria as a kontri of particular concern, accusing di Nigeria govment say dem no dey do anytin to stop di "Christian genocide" wey dey hapun for di kontri.
"Christianity dey face existential threat for Nigeria. Dem dey kill thousands of Christians. Radical Islamists dey responsible for dis mass slaughter... Wen dem dey slaughter Christians, or any such group like e dey happun for Nigeria, sometin gatz be done," Trump tok.
But di Nigeria govment kiakia deny di accuse and tok say wetin President Trump tok no be di true-true picture of wetin dey hapun for di kontri.
"We dey commited to handle di problem of extremism wey special interests dey fuel, wey don help build di decay and division for kontris around di intersecting West African and Sahel regions," Yusuf Tugar, di Minister of Foreign affairs dat time tok in response to di US govment declaration.
Since dat late 2025, di Nigeria govment say dem don dey make efforts to truly show say dem dey work to solve di ogbonge problem of insecurity wey dem say e dey affect evribodi for di kontri, both Christians and Muslims.
Part of di efforts na to start di mass trial of hundreds of terrorism suspects wey security officers bin don arrest and put for detention for many years.
For April of 2026, more dan 600 boko haram suspects or pipo wey bin don collaborate wit terrorists, appear for di Federal High Court for Abuja wia many of dem chop prison sentence of betwin five years to live imprisonment.
"We go fight wit every inch of our blood to make sure say we make Nigeria safe haven for evribodi. Di message dey clear, direct and straight forward, and e be say dis present administration no dey take di issue of terrorism wit levity," Nigeria Attorney General, Lateef Fagbemi tok.
On di part of di US govment, dem don also support di Nigeria military by sending dia own troops to di kontri to help wit di fight against terrorism.
Even bifor dat, di US military bin carry out ogbonge airstrikes for di northern region of Nigeria on Christmas day of 2025, on top Islamic State terrorists wey dey camp for areas for Sokoto State.
And di one wey many sabi pipo describe as one of di big success of di US-Nigeria counter terrorism operation, na di killing of notorious terrorist, Abu-Bilal Al-Manuki or Abu-Mainok, who President Trump describe as di "second in command of ISIS for di world".
Na for di Lake Chad Basin wia di terrorist bin camp wit im fighters, na dia di Nigeria army tok say di US-Nigeria joinbodi operation carry out "precision attack" we kpai Abu-Mainok and im squad.
However, killings still continue for plenty Christian communities for Plateu, Benue and Kaduna States for di north-central and northwest regions of Nigeria.









