'Di protest go continue afta June 30 deadline' - South Africa anti-migrant groups

South African protesters
Published
Read am in 4 mins

Di protest against undocumented migrants for South Africa go continue until di govment introduce tougher laws against illegal migration, Jacinta Ngobese-Zuma, di leader of March and March movement, tok.

She say March and March go dey protest evri Thursday for di next six months to force di govment to "get rid of" undocumented migrants wey still dey for South Africa.

Meanwhile, one demonstrator - wey be part of anoda anti-migrant group, Operation Dudula - tell BBC say dem go "push di police" to arrest foreigners wey no dey di kontri legally.

Protesters march against illegal migrants for South Africa
Protesters march against illegal migrants for South Africa

On Tuesday, 30 June, thousands of of pipo bin demonstrate for South Africa main cities, as dem call on all undocumented migrants to leave di kontri.

Anti-migrant groups bin don set Tuesday as di deadline for migrants wey no get documents to leave. Di groups come out in large numbers and march across various cities for di kontri.

Bifor di deadline, many foreigners don already begin dey self-depot to avoid violence and intimidation.

South African police say 25,000 foreigners don dey repatriated so far. Most of dem na from oda African kontris.

How June 30 protests waka

Police deployed for di protest

To ensure say di protest dey peaceful, police officers and private security guards for South Africa mount ground.

Di Ministry of Police tok say di protests dey largely peaceful across di kontri, wit small-small cases of looting.

However, di Minister of Police Firoz Cachalia say dem deploy di army "in case of emergency" for some parts of Johannesburg and Durban.

Police also confam say di arrest of three pipo for Hillbrow, one suburb area for Johannesburg, wey get high migrant population, afta two pipo injure during protests.

According to police, di three suspects "open fire for protesters wey bin dey waka through di street" and di marchers retaliate by "torching di suspects' vehicle". Among di pipo wey injure, na one 17-year-old.

Some protesters throw bricks, break di windows of some houses for Yeoville, anoda suburb wia many African migrants dey live.

Shops for di city centre bin dey closed, while police presence dey heavy on major streets.

For one neighbourhood for Germiston, about 15km (nine miles) from Johannesburg, demonstrators bin go pipo houses, begin dey evict residents dem suspect be foreign nationals and dey hand dem ova to police officers, as dem insist say di police must check dia documentation, local media report.

Police say dem arrest five pipo ontop accuse say dem loot one foreigner shop for Johannesburg biggest township, Soweto.

Dem also arrest about 10 pipo say dem allegedly loot for KwaZulu-Natal province, dem also arrest one woman ontop accuse say she attack one police officer and one man for "intimidation" afta reports say dem beat one foreign citizen up, police tok.

However, di police for South Africa say dem go follow tori pipo tok later today (Wednesday), to provide update on di anti-migrant demonstrations wey happun on Tuesday.

Protesters march against illegal migrants for South Africa

Police tok say dem don arrest about 50,000 migrants since January ontop accuse say dem dey di kontri illegally.

Many African migrants bin move go South Africa around di time white-minority rule end for 1994, wit di hope for a beta life.

But as South Africa dey face unemployment rate of more dan 30%, anti-migrant sentiments don rise.

Ghana, Malawi, Mozambique, Nigeria and Zimbabwe don dey organise repatriations by air or bus ova di last few weeks - wit about 3,500 foreigners wey don volunteer to leave.

South African authorities claim say more dan 500 Nigerians repatriated no get correct papers, claim wey Nigeria disagree wit.