Anti-immigration protests start for South Africa as deadline for migrants to comot take effect

South Africa protesters
Published
Read am in 2 mins

Anti-migrant protests don start for South Africa as di June 30 deadline wey pressure group March and March give undocumented migrants to comot for di kontri take effect today.

Demonstrators gada for several locations on Tuesday under heavy security presence, as authorities dey closely monitor di situation amid fears say di marches fit trigger violence.

Police and oda security agencies don dey deployed across key provinces, including Gauteng, KwaZulu-Natal and di Western Cape, to maintain law and order and prevent repeat of previous xenophobic attacks.

Di South African govment don distance diasef from di ultimatum, and insist say immigration enforcement na di responsibility of state authorities.

President Cyril Ramaphosa don advise dos wey dey plan to take part for di protest to do am without "intimidation, threats or ultimatums".

Ramaphosa bin don repeatedly warn demonstrators to act peacefully and responsibly, as e also accept di need for immigration reforms.

"Some foreign nationals wey dey live for South Africa dey here lawfully," e remind citizens for im weekly newsletter.

"Dem dey work, study, raise families, invest for our economy and contribute positively to our society. Dem too dey entitled to di protection of our laws and our Constitution.

"Di right to protest and freedom of expression no allow pipo to threaten or intimidate odas, or to engage in acts of vandalism or violence," e write.

Many pipo don already comot South Africa to escape violence and intimidation. South African police say 25,000 don dey repatriated so far. Most of dem from oda African countries.

Johannesburg, wia dem dey plan one of di protests, dey unusually quiet and all di shops for di area wia marchers go gada dey closed.

For Durban, wey don see some of di biggest protests, dem don scata di white tents wey dem house mostly Malawians as authorities dey race to clear di transit camp.

Women in colourful sarongs siddon on top of dia belongings, as dem queue to board a bus home to Malawi.

One man, Nelson Mbewe, say im bin go South Africa in search of employment to support im family for Malawi.

"But we don face challenges - dem say make we go back home bicos we no get di right documents," e tell BBC.

Authorities don give anti-migrant protests to march for Tuesday for Durban, Johannesburg and oda cities.

Dem warn organisers to ensure say e must not lead to violence, but say dem dey prepared for any potential disruption.

Di police say traditional weapons no dey allowed. Dis fit lead to tension between protesters and di police becos many of di protesters na ethnic Zulus, wey dey always take dia shields, whips and sticks, anytime dem dey demonstrate.

According to di govment, more dan 12,000 immigrants don dey deported or repatriated since one wave of protests start earlier dis year.

Ghana, Malawi, Mozambique, Nigeria and Zimbabwe don dey organize repatriations by air or bus ova di last few weeks - wit about 3,500 foreigners wey don volunteer to leave.

South African authorities claim say more dan 500 Nigerians repatriated no get correct papers, claim wey Nigeria disagree wit.