As E Dey Happen, Osun governorship election live updates: APC candidate Bola Oyebamiji cast im vote

Dis na di live update of di governorship election for Osun state.

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama and Adebola Ajayi

  1. Fotos of destruction wey happun for ADC candidate polling unit

    Ballot box dey for ground wit electoral materials inside wit police pipo leg near am
    Wetin we call dis foto, Foto of ballot box wey don break wey dey for ground.

    Dis na fotos of di destruction wey happun almost immediately afta di African Democratic Congress (ADC) govnorship Candidate Najeem Salam cast im vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

    BBC News Pidgin tori pesin wey bin dey on ground wen e happun tok say some guys come di polling unit and dem break all di ballot box.

    According to him police showface for di polling unit to intervene for di mata.

    Nigeria secret police di DSS don arrest di man.

    Part of di side window glass break, e be like say stong object hit am.
    Wetin we call dis foto, Foto of bus window glass wey break
    Blue canopy wey be like wetin fall by force dey for ground
    Wetin we call dis foto, Canopy wey bin stand dey for ground
    Woman wey dey hold di collapsed voting boot be like say dey dey put am back inside bag
    Wetin we call dis foto, Pesin wey look like electoral official dey pack di polling unit voting boot
  2. Moment wey thugs scata polling unit wia ADC candidate vote

    We don confam say candidate of di ADC Najeem Salam don comot for di area wey violence happun.

    E escape through anoda route.

    Wetin we call dis Video, Osun govnorship election: Live from ADC Candidate polling unit wia thugs scatta election,
  3. Breaking, APC candidate Bola Oyebamiji cast im vote

    All Progressives Congress (APC) candidate, Bola Oyebamiji wear white cloth wit dark navy blue and pink stripe design cap
    Wetin we call dis foto, Di All Progressives Congress (APC) candidate, Bola Oyebamiji cast im vote for polling unit 11, ward 9 Gantry Are for Ikire, Irewole LGA

    Bola Oyebamiji, govnorship candidate of All Progressives Congress (APC) don cast im vote for im polling unit, for Irewole for Osun State on Saturday.

    Di candidate arrive for im polling unit 11, ward 9, Gantry Are for Ikire, Irewole LGA wit im wife and party faithfuls to vote dis morning.

    Na 15 candidates dey contest for di election, including di top contenders, Ademola Adeleke of Accord Party and Bola Oyebamiji of All Progressive Party.

    Osun get 2,339,233 registered voters, but na only 1,906,390 of dem, wey be 81.50%, don collect dia Permanent Voter Cards (PVCs) wey dey eligible to participate for di Saturday poll.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  4. About 100 pipo dey police custody for di last one month - Osun State Commissioner of Police tok

    Osun State Commissioner of Police wey dey in charge of di 2026 election, Mr Erale Samuel Etaif say dem don arrest about 100 pipo.

    Im add say di pipo wey dey dia custody come from neighbouring states of Ondo and Ekiti to scata di election for di past one month.

    Howeva, im clarify say dem neva arrest anybody becos of electoral violence today (election day)

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. DSS arrest man wey cause kasala for ADC candidate polling unit

    Di man wear purple cloth, e kneel down for ground and e hold money(cash) and and green bottle for hand
    Wetin we call dis foto, DSS catch pesin wey cause kasala for ADC candidate, Najeem Salam polling unit.

    Kasala burst for di African Democratic Congress (ADC) candidate polling unit.

    BBC News Pidgin tori pesin wey dey on ground wen e happun tok say some guys come di polling unit wia dem break all di ballot box.

    According to him police showface for di polling unit to intervene for di mata.

    "We no know wia di ADC candidate dey currently...some guys don scata dis polling unit" im tok

    Latest tori be say Nigeria secret police di DSS don arrest di man.

  6. Husband carry im wife wey no fit waka to go vote

    Elderly man and woman dey ontop okada, di man dey ride di okada whuile di woman sidon for back as she hold her stick
    Wetin we call dis foto, Husband carry im wife wey no fit waka ontop im okada make dem go vote.

    Elderly husband and wife come to vote.

    Even though di mama no fit waka, she still try come out to vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

  7. Osun state govnor Ademola Adeleke call for free and fair election

    Adeleke Ademola for Osun

    Wia dis foto come from, Gov Ademola Adeleke/Facebook

    Wetin we call dis foto, Foto of Ademola Adeleke

    Govnor of Osun State, Ademola Adeleke don call on di Inspector General of Police, Olatunji Disu say dem want only free and fair elections for di Osun state election.

    Di Accord Party gubernatorial candidate tok dis on Saturday morning afta im cast im vote for ward 2, Ede North, Osun State as im dey run for im second term in office.

    Adeleke tok say dem no want any kasala for Osun State during dis govnorship election.

    Adeleke tok say make police no just move di ballot paper go di state capital as e suppose go ward, local govment bifor e go reach di capital.

    "I don tell di inspector general of police say we no want violence. Na free and fair election we want," Adeleke tok.

  8. Breaking, ADC govnorship candidate Najeem Salam don vote

    African Democratic Congress (ADC) govnorship Candidate Najeem Salam don cast im vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

    Inec official put Bvas for ADC govnorship candidate, Najeem Salam face
    Wetin we call dis foto, Inec official dey accredit di ADC govnorship candidate, Najeem Salam wit Bvas for im polling unit.
    Najeem Salam wear all white cloth wit black cap, oda pipo stand near am
    Wetin we call dis foto, ADC govnorship candidate, Najeem Salam for im polling unitg
  9. Allegations of vote buying dominate Osun election

    Vote buying allegations

    Tori of alleged vote buying dey happun for some polling units for di Osun State govnorship election.

    Polling Unit 13 Iroyin Ayo Open Space Ward 04 Ejigbo LGA

    around 10:17am dem see case of vote buying and vote selling.

    Dem catch some party members wey dey carry cash dey try buy pipo vote.

    Di voters catch dem and collect di money from dem.

  10. Bola Tinubu tell Inec to avoid mago-mago, Many threats and alleged tori of attack bin dey fly upandan during di build-up to di election

    Nigeria President, Bola Tinubu

    Wia dis foto come from, Nigeria presidency

    Wetin we call dis foto, Nigeria President, Bola Tinubu

    President Tinubu tell Inec, security pipo to make sure say magomago no dey for Osun govnorship election and make dem dey peaceful, transparent, and credible.

    Oga Tinubu tok for statement on Friday wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga post ahead of di election on Saturday, 15 August, 2026.

    “As di pipo of Osun State dey go dia polling units to elect vote who go govern dem for di next four years, I call on di Independent National Electoral Commission to ensure orderly conduct of di election.

    Di election must dey transparent, free and fair. I urge Inec to ensure di integrity of di process”

  11. Voting stop for Ademola Adeleke PU sake of poor internet

    Electoral officials wey dey coordinate di election for one polling unit in Ede North, Osun State.
    Wetin we call dis foto, Electoral officials dey operate BVAS

    Voters wey dey on ground for polling unit 9, ward 2, Ede North, Osun state complain about di slow electoral process for dia polling unit due to di poor internet connection for di area.

    Dis na di polling unit wia Osun state govnor, Ademola Adeleke just cast im votes some minutues ago

    Di voters tok say di BVAS for di polling unit dey dey function slowly and e make am difficult for INEC officials to accredit voters.

    As at 8:33 am, Ademola Adeleke bin arrive for di polling unit wit im party supporters to cast im vote for Ward 2, Abogunde Compound, Ede North for during di Osun state govnorship election.

    Di flagbearer for di Accord Party dey bid to return back into office for im second term.

  12. Breaking, Govnor Adeleke don vote

    Govnor Ademola Adeleke of Accord party don vote
    Wetin we call dis foto, Govnor Ademola Adeleke of Accord party don vote

    Governor Ademola Adeleke don cast im vote for im polling unit 9, ward 2 for Ede North Local Government Area of di state.

    Our tori pesin Adesola Abisoye say di govnor come di polling unit wit some members of im family.

    E vote around 8:33am.

    Di govnor follow for one of di first voters.

  13. Who be di top candidates

    Ademola Adeleke (Accord), Bola Oyebamiji (APC), Najeem Salam (ADC), Adeagbo Yemisi (ADP)

    Wia dis foto come from, Facebook

    Wetin we call dis foto, Ademola Adeleke (Accord), Bola Oyebamiji (APC), Najeem Salam (ADC), Adeagbo Yemisi (ADP)

    Na 15 candidates dey contest for di election.

    Dis na even though sabi pipo tok say na about three of dis candidates get beta chance to win am.

    Out of di 15 candidates, only one na woman. Di main candidates na -

    Ademola Adeleke - Accord

    Bola Oyebamiji - APC

    Najeem Salam - ADC

    Adeagbo Yemisi - ADP

  14. Wetin to know about Osun election

    Logo of INEC polling Unit

    Govnorship election for Osun state don start across di 30 Local Govment Areas of di state.

    Dis na di 7th time dem go conduct govnorship election for di state since civilian rule return for 1999.

    Govnorship elections don happun for di state for 1999, 2003, 2007, 2010, 2014, 2018 and 2022.

    Di election na one of di off cycle elections wey dey happun across Nigeria. Dis na sake of court judgement wey bin remove one sitting govnor and install im opponent for di seat after three years.

    Di election go start by 8:30am and close by 2:30pm according to di Independent National Electoral Commission (Inec).

  15. Una welcome to our live coverage of Osun governorship election

    We welcome una to di live coverage of dis ogbonge election for Osun state.

    Dis na di last of di off cycle election for Nigeria wey dey always happun before di general election.

    Make una tanda wit us inside dis page for live updates of di election as e dey happun.