Lagos State extend tax returns filing deadline - how to file individual tax returns

Wia dis foto come from, Babajide Sanwo-Olu/Facebook
Di Lagos State Internal Revenue Service (LIRS) don extend di deadline for filing individual annual tax returns by two weeks, from 1 April to 14 April 2026.
LIRS make di informate on Monday 30 March for one press statement wey di Head of dia Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, sign.
According to Oyelude, dem extend di deadline to provide individuals wit additional time to complete and submit accurate tax returns.
Di federal govment for January tok say evri Nigerian gatz file annual tax returns by 31 of March as di new tax law bin take effect.
Taiwo Oyedele, wey be di former chairman of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, say di deadline cover returns "by 31st March of di year in respect of di previous fiscal year," and add say di requirement apply to all taxpayers including low-income earners.
"All of us gazt file our returns, including dose wey dey earn low income," e tok.
Oyedele say tax authorities dey work to make filing simpler and more accessible across states.
"I dey sure say di tax authorities, joint revenue boards, and various state internal revenue services dey work on how to make dis process simpler and easier," Oloyede tok.
Step by step guide to file individual tax returns
- Log into etax.lirs.net
- Log in wit your taxpayer ID and password
- If you no get taxpayer ID, click on create new taxpayer ID and provide di required information.
- Afta you log in, make sure say your profile information like address, phone number, email, picture and dey up to date.
- Click on 'Returns' for di dashboard located for di left side of your screen, den click on 'Employer Filed Returns': At least three years tax returns gatz dey displayed, di relevant years na 2023, 2024 and 2025
- Write down your gross income for each of di three years displayed
- Click on 'My Tax Returns' under Returns for di dashboard and den click on 'File Returns Here' for di top right corner of your screen
Start to file your returns on di displayed pages as follow:
- Chose di year starting wit 2023
- Under 'Salary', put your 2023 Gross Income (from di figure wey you don write down)
- Scroll down di page and click on Next
- On di next page displayed, type your House Address under Address
- Den type 'Rent' under Accommodation Type
- Choose Tenant under Ownership Type if you be tenant
- Type in di rent wey you pay
- Di next na Date Started wey be JANUARY 1 2023 and Date End wey be December 31 2023 for year 2023
- Click on Confirm Submission for di bottom right corner of your screen.
- Afta dat, file for 2024 and 2025.









