'Ketamine Queen' chop 15 years prison sentence for selling drugs wey kpai actor Matthew Perry

    • Author, Nardine Saad
    • Reporting from, Los Angeles
    • Author, Sareen Habeshian
    • Reporting from, Los Angeles
  • Read am in 4 mins

Dem don sentence one Los Angeles woman wey dem name "Ketamine Queen" to 15 years in prison for selling drugs wey lead to di death of Friends actor Matthew Perry.

42-year-old Jasveen Sangha, bin plead guilty last September to five charges, wey include one count of distributing ketamine wey result to death or bodily injury.

Prosecutors describe di American-British dual-national home as a "drug-selling emporium" wey dey fund lavish lifestyle.

Dem find Perry, wey bin struggle wit addiction for years dead inside di hot tub of im Los Angeles house for October 2023.

Investigators determine say na di acute effects of ketamine cause im death.

Ketamine na dissociative anaesthetic wey get some hallucinogenic effects and na only physician suppose administer am.

Sangha appear for one Los Angeles federal court on Wednesday for di sentencing, she cry for di courtroom, family and friends follow her.

Di sentencing judge say she no show remorse in di last couple of years.

Ahead of Sangha sentencing, Perry stepmother Debbie Perry, bin ask di judge to hand di maximum possible prison sentence.

Sangha cause "irreversible" damage, Debbie Perry tok for inside one victim impact statement wey dem submit give di California court on Tuesday.

"You cause dis... You wey get talent for business enough to make money choose di one wey dey hurt pipo," she tok. "Please give dis heartless woman di maximum prison sentence so she no go fit hurt oda families like ours."

Federal authorities discova dozens of ketamine vials during raid for Sangha Los Angeles home and accuse her of supplying di injectable drug from her "stash house" for North Hollywood since at least 2019.

Dem also see thousands of pills wey include methamphetamine, cocaine and Xanax for her house.

Sangha bin initially deny di charges but agree to change her plea for August, just weeks bifor her trial dey scheduled to begin.

As part of her plea agreement, she also plead guilty to selling ketamine to one man wey im name na Cody McLaury for August 2019, wey die hours afta di purchase from drug overdose, according to di justice department.

According to her attorneys, Sangha don dey for detention since August of 2024.

Family and friends bin file several letters in support of Sangha for court.

Sangha lawyers for March bin ask di judge to issue a more lenient sentence, as e argue say she don "accept responsibility for serious criminal conduct" and she no get prior record.

With additional reporting by Regan Morris and Peter Bowes.

Perry, best known for playing wise-cracking Chandler Bing for di long-running 1990s US TV sitcom Friends, bin struggle for decades wit substance addiction and e bin dey take ketamine as part of supervised therapy for depression.

Sangha na one of di five pipo - including medical doctors plus di actor assistant - wey US officials say supply ketamine give Perry, dem say e exploit im drug addiction for profit, wey lead to im overdose death.

Di oda four also agree to plead guilty to charges for di case.

Dr Salvador Plasencia, wey supply di actor wit ketamine for di weeks bifor im death, dey sentenced in December to 30 months in prison.

Also for December, Dr Mark Chavez, one California doctor wey sell di ketamine give Perry, dey sentenced to eight months of home detention and three years of supervised release.

Di San Diego-based physician bin admit say e obtain ketamine from im clinic and one wholesale distributor through one magomago prescription and e sell am give Plasencia, wey supply am give Perry.

Perry live-in assistant Kenneth Iwamasa, wey help purchase and inject di actor wit ketamine, dey scheduled to dey sentenced later dis month but im legal team don request for postponement.

Eric Fleming, wey sell di ketamine e obtain from Sangha to Perry, dey scheduled to chop im own sentence for June.