Kenya authorities issue June 30 deadline to all taxpayers - how to file income tax returns

William Ruto

Wia dis foto come from, Nicolas TUCAT / AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di Kenya Revenue Authority (KRA) don issue deadline for all taxpayers to file dia 2025 income tax returns to avoid penalties.

Kenya authority fix June 30 as di deadline for all taxpayers to submit di returns say dem no go extend di deadline.

According to dia statement, di tax authority say all taxpayers wey get income tax to file gatz do am bifor di deadline end on Tuesday and filure to do dat go lead to penalties wey go affect tax assessments.

"Kenya Revenue Authority (KRA) dey call on all taxpayers wit Income Tax obligation wey neva file dia 2025 Income Tax Returns to do so immediately, ahead of di statutory filing deadline of midnight on Tuesday, 301h June 2026."

"KRA wish to remind taxpayers say dem no go give any extension of di filing deadline. All returns gatz dey submitted on or bifor 30th June 2026, in accordance wit di law."

Di authority say make di millions of taxpayers wey dey Kenya no wait till last minute bifor dem do di tax filing.

As part of dia efforts to help taxpayers wey wan file dia returns, di Kenya Revenue Authority say dem increase di hours dia office dey open, so pipo wey wan file dia return go fit do am.

"Additionally, KRA extend working hours for various customer support channels across di kontri to ensure say taxpayers receive timely assistance."

Dem add say although some delays fit dey sake of di number of pipo wey dey try access di platform to file dia tax return, but early filing go give more time to resolve any issue wey go sup during di filing.

Di authority say dem go support evrione wey wan do di filing.

Although, di Commissioner General of Kenya Revenue Authority Adan Mohamed say dem don begin engage di National Assembly Departmental Committee on Finance and National Planning during dia stakeholder engagement on proposals inside di Finance Bill, 2026.

KRA general say dem go propose amendments to various tax laws, wey include di Income Tax Act, to help revenue collection and promote fairness and efficiency within di tax system.

How to file Kenya tax return and wetin be di penalties

According to di tax authorities, anyone wey fail to file dia tax return go dey subjected to default assessments.

Dem say to file tax for Kenya no be just obligation, na part of development to help di govment finance di sector.

"Filing your tax return dey more dan legal obligation, na contribution to national development. Evri return wey you file go support transparency, strengthen di tax system, and help di Govment finance essential public services wey go benefit all Kenyans."

Di tax authorities say di deadline day go dey busy but dem dey gidigba to offer support to help di filing process.

On how taxpayers fit file dia returns, di authorities say dem get different platforms wia pipo fit file di taz returns including dia website, dia office, WhatsApp assistance and USSD.

"For di 2025 Year of Income, taxpayers fit declare valid business expenses and e go dey subject to validation afta submission."