Judgement day for Kenya pastor wey chop accuse say e order parents to starve dia children to death

A close shot of a bald man looking through the bars of a cell
Wetin we call dis foto, Paul Mackenzie operated his church for 16 years, attracting thousands of followers
    • Author, Thomas Mukhwana
    • Role, Africa correspondent
    • Reporting from, Shakahola
  • Published
  • Read am in 6 mins

One Kenyan court don ready to deliver judgement for one mass murder case wey involve doomsday preacher Paul Mackenzie.

Mackenzie and 29 of im followers chop accuse for di murder of 191 children.

Im cult chop accuse say dem force children to starve to death so dem go fit "meet Jesus". Im doomsday doctrine say education bin dey forbidden and modern medicine bin dey considered as "evil".

Mackenzie and di 29 odas don plead not guilty to murder, and dem repeatedly insist say dem no force anybodi to kpai.

Mackenzie former head of security, Enos Amanya Ngala, bin initially chop accuse but e enta plea deal and become witness for di prosecution.

Mackenzie and oda leaders of di cult dey face oda legal cases, including alleged terrorism, extreme religious belief and say e dey deny education to children.

But dis na di first time di pastor go face a verdict on di most serious charges of murder.

Authorities say dem find 400 bodis for shallow graves for Shakahola forest near di Kenyan coast, wia Mackenzie bin lead im followers from across di kontri.

Seventeen men bin dey hired from di nearby town for di horrifying task of digging up di shallow graves. Some receive payment of just $8 (£6) a day.

"Evri grave we find get at least three bodis," James, one of di gravediggers, tell di BBC. "Some of di remains na of children as young as a few weeks old."

"We once find 12 bodis of children for one line inside one grave. E bin dey massive, di bodis bin dey arranged like clothes. One ontop of anoda."

Gravediggers say bodis of some of di children wey dem find, "dia hands and legs bin dey tied and dia bodis bin dey wrapped in bedsheets".

Gravedigger and oda pipo wey wear protective helmet and vest stand for place wey resemble graveside
Wetin we call dis foto, Dem bin pay Salim Karisa about $8 per day to dig up dozens of dead bodis

Although many of Mackenzie followers bin come from anoda area for Kenya, some of di dead bodis na pipo wey di community pipo sabi sake of say di cult pipo dey go di nearby Shakahola town for supplies and to fetch water from di River Galana wey dey pass through di town.

"We go carry pipo somtimes on our motorbikes enta forest," na wetin anoda gravedigger Salim Karisa tok.

"But dem dey plan am well and na secret wey nobodi fit tok wetin dey happun inside."

Stephen Mwiti, wey dey 48 years tok as e lose all im six children to di cult and e see "many bald women and tens of children" wey dey surround Mackenzie for im house wen im bin go confront am.

Mackenzie dey forbid make-up and hairstyles, so e bin tell women to shave dia hair or make dem leave am make e scata.

Mwiti former wife na one of di pipo wey dem accuse alongside Mackenzie.

"If I bin meet Pastor Mackenzie today, one of us suppose die," she tell di BBC.

Man wey dey sad like say e dey tink look down. E wear polo shirt wey resemble ash colour, im hair dey shaved.
Wetin we call dis foto, Stephen Mwiti say im six children die for di forest

"All six of my children die for di Shakahola forest," Mwiti tok - e look emotional as e hold photograph of im family. "I only see and bury di deadibodi of my son Samuel."

"Dis little tin hia na wia all my misery start," Mwiti tok as im point to one TV wey dust don cova and cable box for im house for di coastal town of Malindi, 70km (43 miles) from Shakahola.

Na from di TV Mackenzie doctrine enta im house.

Di pastor bin establish Good News International Ministries for 2003. Ova di next 16 years, di church becom popular to draw thousands of followers wey dey attend oda branches across Kenya.

Im church bin run one television station wey dem call Times TV wey dey broadcast im sermons from im church for Malindi.

Mackenzie End Days sermon include conspiracy theories wey describe education as "evil", healthcare as "against di doctrine" and digital identity cards as "di mark of di devil".

Foto wey dey show part of di Times TV Hall
Wetin we call dis foto, Dis na di building from wia Mackenzie dey broadcast im sermons

Mackenzie son, Dan Paul Mackenzie, say im bin work as cameraman for di church. Di children go sidon for back, adults for middle, and evri oda pesin go sing worship songs for all di morning".

Di pastor go start im strong emotional sermons for afternoon, some of dem include "casting out demons".

Di main church shut down for 2019 and Paul Mackenzie bin move to Shakahola forest, wia e encourage im devotees to follow am.

Peter Shukrani, wey dey 23 years say im mama bin relocate to Shakahola wit am dat time.

Im start to go Mackenzie church wen im bin dey eight years old and im describe am as im "spiritual father", e add say "im no go fit tok any bad word about am".

Wen im bin dey for forest, Shukrani bin sick and im condition bin bad well-well becos dem ban medicine.

"My mama go throway all di medicine wey I suppose take becos she believe say only God fit heal me," Shukrani tok.

Dem bin describe di community as mud houses wey scata across di big forest. "We bin live quiet normal life, fasting for few days den we go chop small food," Shukrani tok.

By March 2023 wen local herders recova di first deadibodi, hundreds of pipo bin don die. "We go carry pesin comot from di forest but dem go dey veri weak to di point wey dem go die for our arms," Salim Karisa, one of di gravediggers explain.

Shukrani na one of di men wey dem bin rescue from di forest for March 2023.

Im bin dey sick and im bin dey for bed for weeks until dat point, but im condition worsen becos im mama go throway all di medicine wey im need to recova.

"My mama believe Pastor Mackenzie doctrine say medicine na evil," Shukrani tok.

"I for don die if dem bin no rescue me from Shakahola forest."

For di 298 pages wey detail di charges against am for dis current case, 190 out of di 191 victims dem accuse Mackenzie and im followers of killing na children.

Dem neva still identify some of di dead bodis sake of say dem don rotten well-well.

For di court documents, dem refer to many of dem as "unknown male child" and dem identify dem by location of dia grave and di date wey dem discova dem.

Despite di suffering wey Mackenzie followers bin endure, men, women and children wey die sake of starvation, strangulation and some wey dem hit wit heavy objects many times bifor dem die, plus im own suffering, Shukrani believe say Mackenzie "na good pesin wey care for me".

"Mackenzie no force anybodi to fast. Pipo bin make dia choice by demsefs becos of dia belief," Shukrani add.

"I still love am and im still be my pastor."

On di oda hand, Dan Mackenzie believe say dem suppose find im papa guilty of murder.

"Im be di leader, im be pesin wey dem bin dey look [up to]. So im be murderer of mass killing."