You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Strait of Hormuz 'completely open' for commercial ships as ceasefire kontinu, Iran tok
Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi tok say di Strait of Hormuz dey "completely open" for di "remaining time of di ceasefire".
E tok dis one for statement or X, wia e tok say, "in line wit di ceasefire for Lebanon, di passage for all commercial vessels wey dey pass Strait of Hormuz dey declared completely open for di rest of ceasefire, for di cordinated route wey di Ports and Maritime Organisation of di Islamic Rep. of Iran".
Ova 2,000 pipo na im don die for Lebanon inside di six week kasala and one in five pipo don run from home. Even Israel sef reveal say two of dia civillians and 13 sojas don die.
Di US bin announce say dem go start naval blockade of di Strait of Hormuz earlier for di week. Dis na afta Iran bin close di busiest oil shipping channel for world for weeks afta di US-Israeli attack for Iran for February.
In response to di news, US President Donald Trump tok thank you as e tok for im Truth Social say, "Iran just announce say di Strait of Iran dey fully open and dey readi for full passage, Thank you."
Di price of crude oil don fall well-well afta di announcement from Iran.
Since di annoucement, di cost of barrel of Brent crude bin fall to under $90 a barrel even though di price bin dey at about $98 earlier for di day.
NYMEX light sweet crude wey be di US benchmark, di price don also fall yakata.
Bifor di kasala start, Brent crude bin dey trade at just under $70 a barrel. E bin rise ova $100 for early March and jump reach ova $119 later dat month.
Bifor di reopening of di Strait, one 10 day cease fire start between Israel and Lebanon.
Meanwhile, di oga of di International Maritime Organisation (IMO) dey try understand wetin Iran mean by say dem go open back di Strait.
Dis na as even though di fight fight don match brake plenti US and Iran military still dey ground and worry dey say e go mean ongoing gbege for id safety of ships and dia crews.
Di secretary genral of di IMO Arsenio Dominguez wey bin dey find way to reopen di Strait tok say, "we dey currently verify di recent announcement wey relate to di reopening of di Strait of Hormuz, in terms of dia compliance wit freedom of navigation for all merchant vessels and secure passage wit di use of di IMO established Seperation scheme"
Even as all di jollification dey happun, commercial ships for around di Gulf no dey rush waka through di Strait of Hormuz o.
One oil and gas operator wey no call im name say dem no dey do first ro pass dia as na unecessary risk wey dem no wan take.
Anoda company wey call demselves Stena Bulk wey dey operate oil tankers for dat yard tok say dem dey torchlight di mata, well well.
Dem tok say "di safey of our crew and vessels na wetin be di koko of all our routing decision and we no go waka dia till we know fully say e dey safe to waka dia."
Wetin we sabi about Israel-Lebanon Peace Deal?
Di ceasefire go start for 10 days even though US say dem fit increase am.
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say e go be beta opportunity make dem sign "hisptric peace agreement" wit Lebanon.
Iran backed Hezbolla don gree for di ceasefire even as dem tok say e must get "one ogbonge stop to attacks all ova Lebanese territory and no freedom of movement of Israeli forces".
Even as Hezbolla say make dem comot Netanyahu tok say Israel go stay for 10km-deep (6.2 mile) "security zone" in southern Lebanon.
Di US State Department say under di deal, di Lebanes govment must take steps so Hezbollah no go attack Israel.
As di ceasefire bin dey start, di Israel Defense Foces (IDF) drop statement say dem don hit ova 380 targets of Hezbollah for southern Lebanon in di last 24 hours.
According to di statement, di targets include, rocket launchers, headquarters and Hezbollah members gan-gan.
Wetin be di Strait of Hormuz?
Di Strait of Hormuz na important shipping route wia about 20% of di world oil and natural liquified gas dey transported.
Strait of Hormuz na one length of water wey dey between Iran and Oman.
Im entrance and exit dey around 50km wide, and about 40km for im most narrow point for middle.
However, dis strait only dey deep enough for mighty ships if dem centre demsef for middle of di water.
Maritime navigation charts assign one safe lane for ships wey dey enta di strait, safe lane for di ones wey dey come out of am, and buffer zone between di two - all specifically for heavy oil tankers.
In total, very big ships must to navigate di channel wey dey only about 10km wide.