'My football style be winning style' - re-appointed Ghana coach Queiroz tok as Black Stars jam wit Ivory Coast, Gambia for 2027 Afcon qualifiers

ghana faces ivory coast on thursday

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana re-appoint Carlos Queiroz to lead di Black Stars for di Afcon qualifiers
Published
Read am in 5 mins

Ghana Black Stars coach Carlos Queiroz wey di football association bin re-appoint don defend im philosophy as im return to take ova di team for di Afcon qualifiers.

Di 73-year-old Portuguese lead di team to di World Cup wia dem comot for di R32 afta 1-0 defeat to Colombia.

Di football association decide to re-appoint di former Real Madrid, Portugal and Egypt coach to take charge of di team and qualify dem for di Afcon afta dem fail to qualify for di last edition for Morocco for di first time in 20 years.

Ghana go jam wit Ivory Coast for 24 September and face Gambia later for 29 September for group C for dis international window.

Di football association don arrange one friendly game between Ghana and Morocco wey go happun for 4 October.

Di Black Stars go later jam wit Somalia for 11 November 2026 for di Afcon qualifiers.

some players withdrew through injury

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana go hope to qualify for di 2027 Afcon afta dem fail to qualify for di last tournament

Carlos Queiroz don call up 29-man squad, Kudus withdraw

Tottenham star Mohammed Kudus wey bin suffer long-term injury wey make e miss di kontri 2026 World Cup don return from injury.

Im play few minutes for Spurs but im no still get match fitness.

Coach Queiroz say im gree wit di decision for di 26-year-old attacker to pull out of di squad.

"Kudus bin dey di right direction afta im injury bifor, but afta im play 70 minutes for im club, tins no really progress well. For my discussion wit di player, we realise say di best decision be to protect im recovery process."

Carlor Queiroz add say, "We no want take any risk, we hope say wit more training and games, Kudus go dey ready for di next round of qualifiers."

Anoda player wey don withdraw na Nathaniel Adjei afta im suffer fresh hamstring injury for Lorient.

Coventry City striker Thomas Brandon-Asante don get call-up afta di withdrawal of Kudus.

Dem also call three oda attackers – Mohammed Fuseini (Derby County), Benjamin Tetteh (Kalba) and Felix Afena Gyan (Igdir Fk).

Defenders Jonathan Adjetey (Wolfsburg), Ebenezer Annan (Rapid Bucaresti), Alidu Seidu (OGC Nice) and Rockson Yeboah (Osasuna), midfielder Rahim Ibrahim (Slovan Bratislava) also bin get late call-up.

"Dis selection dey based on research and monitoring of di players across di world, dia current form and dia fitness," di coach explain.

Full squad

coach Queiroz says he hopes to qualify the team first for the afcon

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Alexander Djiku, Felix Afena Gyan return to di squad

Goalkeepers – Benjamin Asare (Hearts of Oak), Lawrence Ati-Zigi (St. Gullen), Joseph Anang (St. Patrick's Athletic)

Defenders – Gideon Mensah (FC Koln), Baba Rahman (PAOK), Jan Gyamera (SV Elversberg), Derrick Luckassen (Red Star Belgrade), Jerome Opoku (Istanbul Basaksehir), Kojo Oppong Peprah (Fenerbahce), Alexander Djiku (Spartak Moscow), Jonathan Adjetey (Wolfsburg), Ebenezer Annan (Rapid Bucaresti), Alidu Seidu (OGC Nice), Rockson Yeboah (Osasuna)

Midfielders – Kwasi Sibo (Swehly Club), Caleb Yirenkyi (Coventry City), Augustine Boakye (Saint Etienne) Ronald Donkor (New York Red Bull), Ibrahim Sulemana (Sassuolo)

Forwards – Christopher Bonsu Baah (Al Qadsiah), Ernest Nuamah (Lyon), Abdul Fatawu Issahaku (Tottenham), Antoine Semenyo (Manchester City), Ibrahim Osman (Brighton), Prince Adu Kwabena (Viktoria Plzen), Jordan Ayew (Sheffield United), Thomas Brandon-Asante (Coventry United), Mohammed Fuseini (Derby County), Benjamin Tetteh (Kalba) and Felix Afena Gyan (Igdir Fk).

Di coach respond to criticism about im defensive philosophy

Pipo bin criticise di 73-year-old and im philosophy, but Carlos Queiroz say di most important tin be to win games.

Ghana beat Panama wey dem play 0-0 draw wit England for di World Cup bifor dem lose to Croatia.

Di Black Stars hold di Three Lions of England well wit defensive masterclass to prevent Harry Kane and di odas from scoring.

Many pipo tok say Ghana do well for dat game, but some critics say di approach for di odas games for change.

But di coach say di philosophy no dey mata, na only results.

"My style of football be winning style. I neva see any coach wey lose dia job sake of playing style. Dem lose dia jobs sake of dem no dey win."

Di coach add say "winning games dey make di style, dat be di law of di game."

Im also tok say di most important trophy at dis moment for am na di next game against Ivory Coast, to win am.

"Time no dey for plenty decisions, time no dey for development, we gatz only deliver."

Carlos Queiroz say "we get goals, our boat bin get some holes, but we still dey float strong."

ghana takes on ivory coast and gambia in one week and then face morocco in a friendly in october

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Di coach throw im support behind 35-year-old Jordan Ayew wey many fans tok say im gatz retire from di national team

Di former Manchester United coach say im dey happy to return as manager for di team afta earlier spell when im lead di kontri to di World Cup.

Fans bin dey para about di selection of 35-year-old Jordan Ayew for di team afta im poor performance for di World Cup.

Many pipo tok say time don reach for di team to move on witout di new Sheffield united player.

But di coach say im still dey trust di former Leicester and Crystal Palace striker.

"I still g diets young boy Jordan Ayew wey bin dey start to renew im career."

Space no dey for Athletic Bilbao striker Inaki Williams wey retire for international football last month.

Thomas Partey wey also bin sign for Saudi club Al Shabab also no get call-up due to injury.

Di Black Stars go jam wit Ivory Coast for di Stade de la Paix, Bouaké at 7 PM (GMT) (8 PM WAT).