Ex-gang boss dey guilty of di murder of rapper Tupac Shakur - Jury

Duane Davis during closing arguments for Las Vegas court and Tupac picture wey dem show for court

Wia dis foto come from, STEVE MARCUS / POOL / AFP via Getty Images / Reuters

Wetin we call dis foto, Duane Davis during closing arguments for Las Vegas court and Tupac picture wey dem show for court
    • Author, Anoushka Mutanda-Dougherty
    • Role, in the Las Vegas court
    • Author, Christal Hayes
    • Author, Shaimaa Khalil
    • Author, Regan Morris
  • Published
  • Read am in 4 mins

Jury don find former gang boss Duane "Keffe D" Davis guilty say im arrange pesin to kill rapper Tupac Shakur.

Dis go be di first conviction in di cold case wey don hold hip-hop fans for neck for almost 30 years.

Di jury find am guilty for di one count of murder wit deadly weapon for di rap star death for drive-by shooting for Las Vegas for 7 September 1996.

Na so di 63 year old sidon for court dey look for Las Vegas bifor e tok say e go appeal di judgement.

For trial, di court bin hear recording of one police interview dem bin do for 2008 wia Davis tok say e bin dey inside di motor from wia dem shoot di gun wey kill Tupac but deny say na im shoot di gun.

Na 25 years be Tupac wen dem kpai am wen e still dey di top of im career as rapper.

In fact e don sell ova 75 million records.

A man pumps his fist in the air as friends and family of Tupac Shakur celebrate a guilty verdict in the trial of Duane "Keffe D" Davis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Shakur's friends and family celebrated the verdict outside the court

Prosecutors bin argue for di trial say even though Davis no shoot di gun wey kill di rapper, n aim arrange di killing and give im nephew, Orlando Anderson di gun wey e take run am.

Davis na former leader of di South Side Compton Crips street gang.

Dem tell di court say Davis bin plan di shooting as do-me-I-do you shooting afta Anderson bin fight wit Tupac and im crew for Las Vegas just hours bifor di shooting.

Di rapper murder bin happun wen di enemity between di East Coast and West Coast rap and dat na even wit di gang kasala wey bin dey happun between di Bloods and Crips. Even dat one sef get deep roots for inside hip-hop for dat time.

Im family bin dey court and bin dey very emotional even as Tupac sister hug di prosecutor afta dem announce di verdict as odas just siddon dey cry.

For outside, Tupac fans too ust dey hail di judgement as some dey cry.

So wetin crack di case las-las na wetin Davis carry im mouth take tok as im don tok again and again say e bin dey inside di white Cadillac from wia dem shoot kill Tupac Shakur.

E bin tell authorities how im hand bin dey Tupac killing for secret police interview for 2008, as dem dey question am about hopw fellow rapper Notorious B.I.G., real name Christopher Wallace take kpai.

Davis come tok more about am for im 2019 book wey im call Compton Street Legend.

But dat book and di media interviews wey follow am bin scata di protective agreement wey im bin get wit authorities wey block dme ot file any criminal charges. Na so court rule say dem fit use im police interview against am.

For closing arguments, prosecutor Binu Pala tell jurors make dem believe wetin Davis bin tok and find am guilty.

For years, e argue Davis don dey tell pipo say, "say e dey responsible for Tupac Shakur murder" through documentaries, im book, podcasts and one police interview.

Palal tell di jury say, "e be di shot caller – in every way, n aim be di leader of di South Side Crips. Wen you get di shot caller wey dey sit shotfum wen di shots dey fired, no doubt dey say e dey responsible."

Davis Lawyers tok say e be liar to free dia client

All through di trial, Davis defence team bin try tell jurors say im comments na just story story. Na just tok-tok so im go fit to sell books and make money.

Even sef, for di closing arguments, im lawyer, Michael Sanft tell jurors say make dem no listen to im client say e dey lie and im lie to sell bookd.

E tell di jury say, "dia be no proof".

But within hours wey dem give di jury di case on Monday, dem give am guilty verdict.

Clark County District Court Judge Carli Kierny set Davis' sentencing for 13 October.

Di judge also explain say, e fit appeal di mata afta di sentencing.