15-year-old boy chop accuse say e sexually molest eight girls

Wia dis foto come from, PA Media
- Author, Lewis Adams
- Published
- Read am in 2 mins
One 15-year-old boy wey dem charge wit sexual offences against eight girls, including one wey be 10 years old, don appear for court.
Di complainants bin dey di between di ages of 10 and 15 at di time, Wellingborough Youth Court heard.
Di teenager, wey BBC no fit mention im name, dey face 22 charges wey relate to alleged incidents wey happun between 2023 and 2025, including rape.
Dem no ask am to enta any pleas during one 20-minute hearing, bifor dem later send di case go Northampton Crown Court for 18 August.
Dem release di defendant, wey im mama follow on bail.
Court withhold details of wia di offences bin take place to protect di alleged victims' right to anonymity.
Di boy dey charged wit:
- Twelve counts of sexually assaulting a female
- Three offences of assaulting a girl under 13 by touching
- Two counts of rape plus anoda two count say e make indecent photograph or pseudo-photograph of a child
- Assaulting a female by penetration
- Possessing a prohibited image of a child and possessing an extreme pornographic image or images
District Judge Amar Mehta told the boy: "Your case is too serious to be tried in this court."
Im bail conditions include say make e no contact di alleged victims and make e no get unsupervised contact wit females under 16.
Di boy bin tok only to confirm im name, date of birth and address. E also ask di judge to explain wetin di Youth Justice Service be.









