Pictures: Hurricane Irma jam Florida

Published

Photos from Florida as "monster" Hurricane Irma land for di city.

Satellite photo on Monday morning show storm Irma as e dey over Florida while another storm- Jose dey for water. Atlantic Ocean taken at 05:30 GMT, 11 September
Wetin we call dis foto, Satellite photo on Monday morning show storm Irma as e dey over Florida while another storm- Jose dey for water.
People dey smoke cigar outside di Germain Arena, where dey keep people to stay during hurricane Irma for Estero, Florida, 10 September
Wetin we call dis foto, Dem give people where to stay for Germain Arena for Estero, Florida.
Dis man dey waka for street wey flood for Miami don cover on Sunday 10 September
Wetin we call dis foto, Dis man dey waka for street wey flood for Miami don cover on Sunday.
Crane wey brake for Miami
Wetin we call dis foto, Crane wey dem dey use for construction for Miami collapse.
Roofs wey destroy for place wey people dey live for Miami, 10 September
Wetin we call dis foto, Di storm blow roof of houses comot for Miami.
Petrol station wey scatter for Hurricane Irma hand for Bonita Springs, Florida, 10 September
Wetin we call dis foto, Dis petrol station really hear am for Irma hand.
Flood water from Hurricane Irma surround one mobile house for Bonita Springs, Florida, 10 September
Wetin we call dis foto, House wey fit move for Bonita Spring full with flood.
People wey dey live for Tampa dey take picture of Hillsborough bay with skyline for background
Wetin we call dis foto, People wey dey live for Tampa dey take picture of Hillsborough bay before Hurricane Irma bin land.
Trees and one thing pikin dey use play as breeze just blow dem scatter
Wetin we call dis foto, Trees and one thing pikin dey use play as breeze just blow dem scatter.
One place wey dem dey keep boat for Hollywood, Florida.
Wetin we call dis foto, One place wey dem dey keep boat for Hollywood, Florida as breeze take scatter am.
Dis petrol station for Biscayne Boulevard feel Irma force well well.
Wetin we call dis foto, Dis petrol station for Biscayne Boulevard feel Irma force well-well.
Car wey water don almost cover finish for Miami
Wetin we call dis foto, Some part of Miami bin receive di full force of Hurricane Irma.
Di National Guard help remove some people from hospitals wey dey Lower Keys area.
Wetin we call dis foto, Di National Guard help remove some people from hospitals wey dey Lower Keys area.