'I neva for one day regret my condition' Abraham Lucky Onoja

Wetin we call dis Video, 'I neva for one day regret my condition' Abraham Lucky Onoja
Published

Meet Abraham Lucky Onoja, a former paralympic lifter turn shoe maker wey im picture trend for social media recently and dey ginger pipo.

Abraham for interview wit BBC Pidgin say e no dey regret being physically challenged.

Since im picture trend for social media, Abraham wey be shoe-maker tok say order don dey flow in from evriwia.

E also tok say im go like teach oda pipo wey be like am im craft.

Video Journalist: Gift Ufuoma