How to make Ekpang Nkukwo

Wetin we call dis Video, How to make Ekpang Nkukwo
Published

Ekpang Nkukwo na very important food for di Efik pipo of Cross River State, south-south Nigeria.

Dem dey cook am for big family gatherings like weddings and e dey take time to prepare.

E get plenti sea food ingredients including bush meat for inside as e be say Cross River get plenti water.

If you wan show pesin wey come your house say dem dey important to you, you fit cook dis food.

Producers: Faith Oshoko and Onyinye Chime

Video: Gift Ufoma