Ships still dey careful about using Strait of Hormuz as Iran issue warning despite ceasefire deal

Wia dis foto come from, Getty Images/Reuters
Di Strait of Hormuz don bicom one focal point of di US-Israel war wit Iran afta Tehran effectively block one of di world most important shipping lanes, wey dey carry about one fifth of di world oil and liquefied natural gas.
US and Iran bin agree to a two-week ceasefire on Tuesday evening on di condition say "safe passage" through di strait go dey guaranteed - but BBC Verify analysis show say na only few vessels don pass since di agreement.
Di disruption, ova di past five weeks, don send shock waves across di world economy, wey don push up energy prices and expose just how reliant international supply chains dey on di strait, wey be only about 33km (21 miles) wide at dia narrowest point.
As well as energy, di Gulf also dey vital for transporting chemicals wey dey needed to process products like microchips, pharmaceuticals and fertiliser.
While di price of oil don fall following di news of di ceasefire, shipping analysts warn say make pipo expect only small-small crossings for now.
"Most shipping lines go want get details and reassurances on wetin e actually take to transit and dose details no dey available," Lars Jensen from Vespucci Maritime tell BBC.
Since di ceasefire come into force, shipping brokerage firm SSY confam to BBC Verify say ships for di Gulf don receive warning from Iran navy say any vessels wey cross withut permission "go dey targeted and destroyed".
By 14:00 BST on 8 April na just three tankers - NJ Earth, Daytona Beach and Hai Long 1 - don pass through di strait since di ceasefire dey announced late on Tuesday night.
Dat na according to BBC Verify analysis of ship-tracking data from MarineTraffic.
Dat compare to di 138 ships wey dey pass through di strait each day, on average, bifor di conflict start on 28 February.
We no know if di three vessels wey cross on Wednesday na di result of di ceasefire, or weda dem don already plan to make di journey.
"E still dey too soon to tell weda dis reflect a broader ceasefire-driven reopening or a previously approved exception," Ana Subasic from di shipping analyst company Kpler tok.
"Notin don really change yet," Jensen add, as e argue say e go take time bifor crews go dey confident enough to cross safely.
BBC Verify analysis of di paths wey di three ships take show dem dey pass one northern route through di strait close to Iran coastline and enta dia territorial waters.
Bifor di conflict, vessels usually dey take a more southerly route through di middle of di waterway.
Wetin be di 10-point plan as US-Iran agree ceasefire to reopen of Strait of Hormuz
Donald Trump say afta tok-tok wit di leadership of Pakistan, ceasefire go dey between di US and Iran if Iran agree to allow traffic through di Strait of Hormuz.
"I agree to suspend di bombing and attack of Iran for a period of two weeks," e tok.
"Dis go be a double sided CEASEFIRE!"
Trump continue and say e go agree to di two-week ceasefire "subject to di Islamic Republic of Iran agreement to COMPLETE, IMMEDIATE, and SAFE OPENING of di Strait of Hormuz".
Trump say Iran don send di US and Israel a ten-point plan.
Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi later announce say Iran go agree to a ceasefire "if attacks against Iran stop".
E add: "For a period of two weeks, safe passage through di Strait of Hormuz go dey possible."
Dis go happun "via co-ordination wit Iran Armed Forces and wit due consideration of technical limitations", e tok.
Iranian media say: "Trump announce two-week ceasefire accepting Iran conditions to end war" and di outlet also refer to "Trump humiliating retreat from anti-Iran rhetoric".
- Complete cessation of di war on Iraq, Lebanon, and Yemen
- Complete and permanent cessation of di war on Iran wit no time limit
- End all fight-fight in di region pata-pata
- Reopen di Strait of Hormuz
- Establish protocol and conditions to ensure freedom and security of navigation in di Strait of Hormuz
- Full payment of compensation for reconstruction costs to Iran
- Full commitment to lifting sanctions on Iran
- Release of Iranian funds and frozen assets wey United States hold
- Iran fully commit to say dem no go possess any nuclear weapons
- Immediate ceasefire take effect on all fronts immediately upon approval of di above conditions










